AMERICAN FOOTBALL, na wetin yankee people dey call dem own football, and come dey call FOOTBALL, SOCCER.


Dis american football tin na one sports wey I don try well well to understand but no still know wetin dem dey do. First of all dem dey call am "football", but na mostly with hand wey dem dey use play am. And almost everytin wey dem dey do for de game resemble wetin rugby players dey do for dia game.

For hia, american football na very big tin. Almost every skool from junior secondari to university get dem own football team. De skools get football programs wey dem dey organize like professional sport programs. Each skool must get standard field. And each team must get dem own supporters club wey dem dey call marching band. Dem go dey play music through out de game.

Den dem get de main professional league! Na for dis league you go see how sports be really big business. I dey talk about multibillion dollar business. You must get ya own standard stadium, and everytin wey professional team suppose get. De money wey dem dey pay players no get part two. And de money wey de owners of de teams dey make from dis players just no get limit.

And den come see as people dey carry dem home team for head like say na dia god. Just like some Naija guys dey carry english premier league teams for head, na so some people for hia dey attach to dem home teams. During regular seasons, dem dey play dia pro-league games for sundays and mondays. You no go see space for any beer palor around town.

Na only very few tins wey I know about de game; like de line backer, quarterback, wide reciever, but odas I no sabi! And den when dem score goal (dem dey call touch down) na de only tin I sabi during de game. When de referee go allow for changes or when im go give dem own type of yellow or red card, I no sabi.

For TV, dem get plenty sports program wey dey analyze american football. Some na about college football, some na for pro football, and odas go dey show games. And all dis one na anoda way to make plenty money for de teams.

De average football player dey like 6 feet and get body. Lekpa pessin no go fit play American football. Dem go jam you troway for one side if you no get strong body. De sports na one kind hard sports. Ee dey very easy to get serious injury. Some don paralyze dem sef because of football. Even some retired players don suffer brain and spinal problem from all dos years wey dem been play football.

But some papa and mama go still dey push dem boys to play football. All dem want na for dia pikin to enter pro-league, so dat dem fit make plenty money. But na only few guys dey make am. De tin no easy at all.

No comments:

Post a Comment

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...