MEXICAN FOOD, MEXICAN STORE and MEXICAN RESTAURANT

I like Mexican food no be small. I fall in love with dis type of food when I been dey skool. With all de fast food wey dey everywhere around de skool, I been dey find am hard to find beta tin to chop. And as I dey find de place wey I fit buy de kind food wey I like, I come jam dis Mexican restaurant wey dem call TACO BUENO.

Afta de first day, na so I begin go dia almost every time. De food just dey sweet me each time I go dia. I begin try all de types of foods wey dem get for dia menu. And I come notice say dem food cheap too.

Mexican food dey very unique, but for me na de closest tin to naija kind of food (except dem no get anytin like garri and soup). Food like taco, enchilada, burrito, nachos and plenty odas be wetin make dem food stand out.

"Mexican food" na de kind of food wey dey common with de people dem dey call LATINOS for hia. Dis na any pessin wey come from any South American country. And na dem people dey run almost any Mexican restaurant wey you enter.

When you Sidon for de restaurant, de first tin dem go give you na wetin dem dey call crispy taco and guacamole (avocado pear wey dem grind). Den you go place ya order. As you dey eat, na so you go dey hia dem type of song for de loudspeaker. And all around de restaurant, you go see pictures and artwork wey go make you feel like say you dey for South America.

When I discover say dem food dey close to awa own, na so I begin find out where I fit buy dem kind of ingredients. Den I come discover Mexican stores. Na hia you go fit buy food stuff to cook dem kind of food. But my aim na to buy tins wey I fit use cook my own kind of food.

Since I no dey live near any place wey I fit find African store, na Mexican store be my closest alternative. Na dia I fit buy goat meat, cocoa yam, wata leaf, all types of pepper, coconut, okro, plantain, and oda types of food stuff wey I dey used to. Afta all dis years, I still neva dey used to American food like dat. I dey like cook de kind food wey I sabi. And na de Mexican stores around my area dey supply me wetin I need.



No comments:

Post a Comment

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...