NAIJA COUPLE AND DEM WAHALA!!- dis man just open him wife yansh for internet

For dos people for Naija wey still dey doubt some of de kata-kata wey dey happen for some Naija families hia, dis youtube video go open una eye well well. Dis husband don really hear am for him wife hand.

My guy just dey lament for de video how him wife tell am say anoda Naija guy dey do clearing and forwarding for her body. De guy tell all him life history from when dem marry for Naija to when dem come yankee, and to how many times de woman don luck am up for no reason.

I watch de whole video and na so I just dey shake my head. Even as I dey tink of marriage, de tin just dey fia me somehow. Naija women dey come hia come turn to anoda tin. No mata de education or de age, most of dem just dey take dem husbands clean ground.

Plenty Naija men don even kill dem wife sake of say dem no fit endure wetin dem wife dey put dem through. Dis woman wey dis man dey talk about na dokita. Can you imagine!! De kind shame wey dis one go cause de pikin dem and dem family no go get part two!! Na wa oo!

But de guy for take style arrange him family mata for private. at least for de sake of him pikin wey go live with de shame of wetin dey happen with dem mama and papa. But ee be like say de guy no fit endure again. Afta 25 years wey dem don marry, my guy go don really tire for him wife nonsense behavior.

For Naija na men dey wear de trouser for dem house, but for hia na de wife dey control tins most times. Dis society give women too much power. If dem vex with you, dem fit destroy ya life with just one phone call to 911. And na only God go save you if de court system believe her story.

Me I neva marry and all dis tory about dis women wey I dey hear just dey make my heart to beat per second per second. I dey pray to God well well oo! And I believe say Him go helep me find de babe wey no go give me too much wahala.

Abeg make una pray for me oo!

1 comment:

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...