NA WA OO! SO JESUS NA BLACK MAN?


All my life for naija, na onyibo man wey I know as Jesus Christ. From de photo wey dey hang for awa church to calendar wey you fit buy for market, na onyibo with long hair wey I dey see. Even sef de "jesus film" wey we dey watch for christmas and easter get onyibo Jesus.

Na when I come yankee I come hia for de first time say him fit be black man. Yes oo..., de tin take style surprise me. Na by accident wey I hia dis one. Me and one akata guy been dey talk, him dey ask me about Africa, and him come dey tell me about dem own experience.

Den as tory come enter religion, I tell am say I be christian. Na dat time him come ask me weda I know say jesus na black man. For my mind I come dey ask my sef weda de guy dey halucinate. But my guy been dey very serious. Him come begin give me history lesson about christainity and how say most people for bible be black men.

Well, me I been no get time to begin argue with am. Weda white or black how dat one take mata? Ee really mata for some people hia oo! I find dat one out by my sef. For de African american community, ee get people wey dem dey call "conscious people". Dis one na people wey wan connect to Africa. Everytin wey dem dey do must get African meaning. And among dem, dem believe say jesus na black man. Dem go quote for bible where dem describe jesus hair like wool and him skin like bronze.

Dem believe say onyibo people just take style whitewash him color to white. Dem get plenty books about dis mata. And even for some movies you go see as dem talk about say jesus na black man. I been see dis one for de movie- Malcolm X wey Spike Lee direct.

I know us christians for naija no get any idea say jesus color fit be controversy, aftarall na onyibo people bring chritianity come give us. So na de color wey dem tell us say jesus be na dat one we go take. So if dis "jesus na black man" tory enter naija, I no know how some people go take am. But I trust most of awa prayer warriors, dem go speak in tongues comot demon for any pessin body wey wan preach to dem say jesus na black man.

No comments:

Post a Comment

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...