TYPICAL BEER PALOR FOR YANKEE

If you be kind of guy wey like to go drink beer palor and you dey for dis country, you go notice de big difference between naija beer palor and beer palor for yankee. De first big difference na say for hia, dia beer palor dey sell almost any type of alcohol wey you fit think of, from beer to wine to all kinds of kai kai.

And dem dey sell dia beer from special tap. Dem go serve you de beer for draft (dis na regular glass cup) or pitcher (dis na big glass jug wey you fit share if una dey for group). But dem still dey sell beer for bottle.


And den oda differences, na say dem must close around certain time. No mata how many people still wan drink you must close. In fact ee get de way dem go don program dem cash register, de tin go stop to work when closing time reach. And so when dat time don dey reach, like 30 mins to de time, de bar tender go begin shout 'last call'. Dat one mean say if you still wan buy drinks, make you hurry buy before dem close.

If you wan open beer parlor, you must get special license. No even try to sell beer without license. Dat one na trouble you dey find for govment hand. And den you go come sign contract with de alcohol companies for dem to supply you with drinks.


Now de bartenders must be people wey don get training of how to sell alcohol. Dem get to learn how to mix most of de drinks wey people go ask for. Dem get to learn how to serve am de proper way. You no fit just wake up one morning den go begin serve alcohol for beer palor. You must get ya own special lisence.

Dat dia work no easy at all. You go see as everybody dey order for dem drinks at de same time, and you must know how to cordinate well. If not na yab you go recieve from all dos drunk people wey dey ask for dem drinks.

And den fights!! I remember when me and some of my guys been go drink for one bar. As we dey dia dey drink, ee no even reach 30 mins when we see dis two guys just dey argue. Dem don dull dia eyes with enough shack. As dem continue to dey argue, no do no do dem begin troway punch. Me and my guys just take suffry suffry comot for de place.

Fight for beer palor na very common tin. When some people don drunk, na dat time dem energy dey enter gear-10. And na sometin wey I neva still fit understand. When me I don jones well well, I dey usually dey very happy and lazy. My energy go don go down well well. I no even get too much power to stand well talkless of to fight. But most people hia dey turn to incredible hulk after dem don drink.


And dis one dey always invite korofo people almost everytime. When dem come na public intoxication dem go knack you with. And na jail you go sleep dat night. And na im make bartenders must shine dem eye well well to see who don ova drink and begin make too much noise. For hia de law say bartenders must stop to sell drinks to any pessin wey dem see wey dey misbehave even if dem ask for more drinks.

If police come to arrest dat pessin, de first tin dem go do na to ask de beer palor when last dem serve de guy wey dey misbehave. And if dem find out say you still dey serve dat guy afta im begin misbehave, den na trouble for dat beer palor too!


Den de food for most beer palor na so so fry fry. Fried chicken wings, french fries, or sometimes dem get barbeque meat. And dis one dey make me remember naija beer palor. I dey miss all de specials like point and kill, suya, fish/goat meat pepper soup, nkwobi and ecetera ecetera!

Chai...! As I dey type dis post now na so I dey swallow spit and dey tink of mama Okey beer palor! Well, make I no too worry. December go soon reach!!!



3 comments:

  1. This comment has been removed by the author.

    ReplyDelete
  2. Helo,me ΐ like dis ur blog wellwell...
    Weldone you hear???
    I don dey follow ur blog tey tey but i decide to drop comment today.....

    ReplyDelete

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...