AMERICAN GREED! no be only naija guys sabi 419, infact dos wey dey do am for hia get PhD for 419

If you still dey tink say na only Naija sabi 419, den you need to tink again! Ee get dis program wey I like to watch wey de name be AMERICAN GREED. De kind of wayo wey dis pipo dey do for hia no get part two. Dia own kind of wayo na 'de more you look de less you see'.

I say eh, dis guys go register dem wayo business, even get headquarters and branches. Everytin go dey legit for de outside, but for inside na proper 419 arrangee!! Most of de wayo biz na for real estate, stock market, pension funds, clinics, oil and gas...., de list no get ending.

De model of de wayo na very simple one- just make sure say you get steady supply of MUGU, if not, den ya tansh don open be dat. Dis guys dey usually knack people wey dem know, dia neighbors, realatives and even sef dem mama and papa.

So far say nobody go find out, na business as usual. Some don even dey dis business twenty sometimes or even thirty years. Ee get one episode wey I watch, dis real estate guy don dey do him wayo for nearly thirty five years. Normal normal, de guy start him biz de legit way, him dey make honest money, but along de line him eye begin chook, so him begin do risky business with people money, and den come begin lose. Instead him go tell him investors, my guy begin 'cook de books'. But na how him take sustain dat lie for thirty plus years shock me.

Abi na doctor wey dey busy dey charge insurance for operations wey I'm no do and de companies just dey pay am millions of dollars for years!! Or na yahoo yahoo boys?! When I see sometimes as dem dey show Naija like de Mecca for Internet fraud, I just dey shake my head dey laff. Naija no reach dis guys for hia half for yahoo yahoo!!

Or abi na credit card fraud? Dat one na multi billion dollar wahala for hia. Ee get guys wey dem work na to dey online dey 'harvest' people bank info. Before you know wetin dey happen dem don debit ya credit card account with thousands of dollars.

And yes..., some go say oh most of dem na Naija guys. Wetin I go say na Naija guys dem dey wan use as scape goat. Dem go show dem for TV like say na dem do am pass. Naija no even near dos wey dey play de big league for internet fraud. We fit dey like division 3 for de league. Dem dey premiership.

Guys dey hack systems dey steal millions of dollars without any trace at all. FBI go trace tire. You no go hia dat one for news. Make ee no be like say dem fall dem hand. But if dem catch you.., na den you go know say chekeleke no be chicken, no mind say dem two start with 'C' and dem resemble small.

For hia, financial crime be like say you don comit BLASPHEMY. Government catch you, dem go skin you alive. Everytin wey you get, dem go collect. From ya best house to de boxers wey you wear for body. Ya family like make dem beg for some of ya tins wey be ya legit property, dat one no concern dem. When dem come for you, no even try to hide anytin, dat one go even make dem increase ya prison sentence.

But na why people still dey get liver to continue to dey play people wayo na im I no fit still understand. De more dem dey catch plenty de more odas dey join for de wayo biz. Maybe na because of wetin dem dey cal for hia de 11th commandment- do anytin wey sweet ya body, BUT MAKE SURE THOU SHALL NOT BE CAUGHT!!

1 comment:

  1. I would like to thank you for the efforts you have made in writing this article. I am hoping the same best work from you in the future as well..
    Cannabis stock

    ReplyDelete

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...