DO AM YA SEF

For here, to do any kind repair for ya house no be small money. No mata how small de work wey you need to do dey, dem go charge you plenty money.

So dis one don make plenty people to decide to dey fix anytin wey spoil for dem house by dem sef. Wetin most people dey do na to go online go watch videos of how to repair dat tin or dem go buy do am ya sef books.

Some people dey repair dem own moto, repair any furniture wey break, change de roof for dem house. And if you get de liver you fit fix any electrical work for ya house. And why most of dis tins dey possible na because say dem get plenty stores wey you fit buy any kind tools wey you need. Dem dey call am hardware store.

OVERWEIGHT

"I no know as una dey do am for Africa, but here for yankee, make you no eva tell woman say she get body". Dat na wetin one babe tell me. I remember most of my intial yans with babes for yaknee. I dey always notice say we no dey too understand awa sef. Some words wey I go use fit mean totally different tin to dem. Na so I go dey explain my sef or begin use oda words wey I feel say dem go understand, lol.

So after I tell dis babe say I like as she get body, ee nearly cause sunami between me and her. Yes oo! Dat day I learn my biggest lesson of wetin you no suppose ever tell babe for yankee. For here, ee dey almost like blasphemy if you tell any woman about her big size or weight. Dat one na no go area. Some women fit divorce you if dem be ya wife, lol.

DOWRY or BRIDE PRICE, WHICH ONE?

I just learn sometin new about de way wey dem dey do marriage for here. De tin shock me well well when I find out about dis tin. I no believe am when I been hear am de first time. So I come ask oda people for confirmation.

No, no be de fact say dem traditional marriage na de one wey we dey call white or church wedding. No be de fact say

EE GET AS DIS ONE BE

One of my guys marry yesterday. Him don dey plan for de wedding for sometime now. But de tin be say de marriage get as ee be. Dis one no be de usual marriage wey two people wey love dem sef decide to do.

Dem plan am BUT both of dem know say no be true true marriage dem wan do. My guy wan arrange him “papers”. I know say dis one no be new tin to most people. Ee dey very common among people wey travel come yankee. For here, once you marry citizen, you go get automatic green card.

So dis one dey make guys (and sometimes babes) to go do dis arrangee marriage tin so dat dem no go deport dem. Life dey hard for here if you no get correct papers. You no fit find work, you no fit get drivers license, you no even fit rent house for some places. De tin hard well well.

AMERICAN SKOOLS


I know say de common belief about skools for yankee na say dem dey very expensive. And some tink say ee dey very hard to gain admission. Na true say some skools for yankee dey very expensive. Even to gain admission fit dey very hard.


But de tin wey most of us no know be say dem get oda plenty plenty  skools wey dey very cheap. I mean skools wey regular person for Naija fit afford, and skools wey cheap pass some skools for Naija . Why people no know about dis one na because of lack of info.


If you get access to internet, phone and post office, you fit gain admission to very cheap quality skools for yankee and Canada from anywhere for de world wey you dey. You no need any agent to helep you get admission. De steps wey you suppose follow dey very straight forward.

You need to know wetin you wan study, de semester you wan start skool and de type of student wey you be. You fit start as freshman (dat na if you just finish high skool OR you only get high skool certificate), you fit start as transfer student (dat na if you already dey unviversity, polytechnique OR college of education AND you wan transfer to skool abroad), or you fit start as Graduate student (dat na if you don gradge from any higher institution and wan do PGD, masters or PhD).

MY EXPERIENCE WITH SOME SHOPKEEPERS

Sometimes when I enter some stores, I go notice say one of de storekeepers go waka come meet me, den come ask me “you need helep?”. Me I been tink say dem dey very friendly and sweet with de way dem go always rush come meet me and ask weda I need helep.

Dis tin don happen to me plenty times and I come dey use to am. But for some reason, I notice say no be everybody dem dey offer dis dem special helep. I notice say most times dem no go even look de onyibo people side. De only time dem go speak to onyibo person be when im come to pay, and dem go ask am if im find everytin wey im need.

And sometimes, when I dey some so called “high end” stores, na so I go see one store worker dey try arrange shelf or goods close to where I stand. I go dey notice tins like dat but I no really understand wetin dey actually happen. Den na later ee come clear my eye say na because dem tink say I be ‘poential” THIEF! YES oo, I mean OLE.

TO MY SISTAS FOR YANKEE

My sistas, how una dey? I hope say everytin dey go well for una side? Well we tank God. Abeg ee get one serious mata wey I wan discuss with una. De mata concern bros dem. Dem carry complain come meet me. Dem say dem don begin tire for una, and say most of una no dey easy to approach oo!

I come dey wonda why ee be like dat. Why una dey make bros dem tink dis way naw? Guys say una too dey give dem levels. Most of una no go wan follow dem talk at all. I hope say una neva begin believe dat nonsense wey akata babes take full dem brain? Dat rubbish wey dem dey call “strong independent black woman”!

I know say una no suppose lower una standard. But wetin most of una need to know be say any guy wey fit make to yankee get serious potential to make. Naija guy no dey eva carry last for anytin. Ee go take time for am too make am, but him go make am finally.
 
Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...