NAIRA VS DOLLAR EXCHANGE RATE

Dis post na some kind of true confession. All of us know say aside from de beta life wey we dey travel abroad for, anoda big reason wey we dey travel abroad and de country wey we dey choose, dey depend on de exchange rate of de currency of dat country money to NAIRA.

Why wey dey like to travel to countries like USA, Canada, UK and so on, na because dem currency dey high. Na one of de reason me I decide to come yankee. When you make dat dollar and den press ya calculator to see how much ee be for naira, ee dey give you confido.

Na im make when some people travel back with some dollars, and den come change am, ee go dey like say dem don make plenty money. I remember anytime I go to send money to pessin wey dey naija, I dey always notice how de cashier eye dey wide anytime I tell dem sometin like, I wan send 20,000 naija money.

Dem go ask me again if I wan send 20 or 200 naija money. For dem mind dem dey see am like say naira and dollar na same value. Den I go come explain to dem say de exchange rate dey different.

And den anytime I read for internet say naira don fall, I go confess to you say I dey take style dey happy. I know say dis one no be good tin at all. I go tell you say most naija people hia dey happy too about am. You go see as dem dey arrange to send money back home for dem relatives to change dollars for dem.

Dis recent time wey naira fall well well, we see as dollars just overflow for naija. Most of dos money come from yankee. Yes..., I know dat one for sure. And all of us see how de tin wan nearly collapse naija economy. Tank God say CBN come decide to stop de flow of too much dollars to de economy.

And dis one come dey make me dey tink about dis exchange rate tin. We wey dey for abroad go dey always complain say naija economy no dey good. When you see naija people dey talk, na so dem go dey curse politicians of how dem dey spoil de economy, and also dey complain how de naira dey fall everyday. And all of us dey always act like say na we holy pass.

But when de naira fall as ee happen last month, you go see as dis same naija people go rush to send foreign currency back home, and den over flood de market. Den pessin go begin wonda weda we dey pray for de economy to always dey bad, and den dey always pretend like say we care about naija economy.

Na wa oo! No be secret say people wey dey abroad get serious SUPERIORITY complex to dos wey still dey back home. Everybody know dat one. But how many of us know say we fit dey contribute to awa bad economy indirectly with dis over flooding of awa own naija economy with foreign currency?

Noting dey wrong with us abroad to send forex back home. But make we no just dey send dis forex and den suck out all de naira wey dey on circulation. Make we send dat money and invest am for sometin wey dey tangible for de economy. Dat na wetin we suppose to dey do.

5 comments:

  1. Nah the SUPERIORITY ish dey vex me with our pipo for hia! Infact, that is one of the reason, I just maintain my lane because the efizy no be 4 hia @ all! Nah wetinnn???
    My pipo sabi yarn, but dem secretly like as # dey fall! Some go dey wait like pesin nah dey play kalu, kalu!
    But western union, no dey follow the # dance o! The rate is still a bit short of #200 to a $1.
    9jas sabi joke with every situation, dat is y, dem, dey say, many go dey save in #, but spend in $! ahahaha.
    If PMB dream come true, and #1=$1, nah wetin pipo for yankee go come do? Move to another country ba? AHAHHAA. But the bitter truth my broda, the exchange rate dey benefit ALL of us! Both for 9ja and yankee! Business people dey make gain well! Imagine if you have to send money to 2-3 every month..how much be pesin salary?

    ReplyDelete
    Replies
    1. my dear dos of us wey dey abroad and awa effizy just dey too much. dis na wetin FELA been call kolo (colonial) mentality.

      and if you no careful you go see ya sef dey always talk BAD BAD tins against naija. instead of us to copy sometin hia and replicate am back home like Chinese people dey do, we go dey waste awa time dey curse we country.

      no be small tin my sista!

      Delete
  2. Shebi buhari. Don talk say e go make. $1 make e be #1?? We dey wait ohhhh!!!

    ReplyDelete
  3. Shebi buhari. Don talk say e go make. $1 make e be #1?? We dey wait ohhhh!!!

    ReplyDelete
  4. Thank you for appreciating this post. I'm grateful

    ReplyDelete

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...