ABOUT DIS BLOG

Una welcome to for my blog. I wan use dis blog to write about my experience and wetin I feel about most of de tins wey I see as ee dey happen for yankee! Most of dem you go don experience am too. But wetin I dey write na for my people dem wey neva fit get chance travel abroad. I want dem to read wetin I dey write so dat dem go know as dis place be.

I know say most of de tins wey you don hia about yankee na true. Oda tins wey you go don hia na proper lai. And oda tins too no just make any sense. So I go try show you as tins be and as I take see am!!

I go dey write constant for my blog at least two times every week. So for you to dey get de latest wey I don write, I go ask you to subscribe to dis blog so dat you go dey get am fresh as soon as I write am.

Life4yankee for any person wey fit understand pidgin english well well. And for dos wey no fit understand, abeg make you meet person wey go explain wetin i write!! I hope una go enjoy my blog. I go dey expect you to dey visit my blog constant.

And any tory wey you read and ee sweet ya bele, make you no forget to leave ya comment. I go appreciate am.


I thank you well well!!!!


Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...