DATE OUTSIDE YA RACE

Dis na topic wey I don postpone tire, but today I don try get enough liver to talk about am. Na de tory of wetin ee be like to date pessin wey come from anoda race, weda na onyibo, chinese or latino, all join.

I no wan begin sound like say me I be casanova, but when ee come for woman mata...., well I go talk say I no dey carry last for dat department. And yes I don date babe from anoda race. And I no go begin use dis my blog to talk say babes from anoda race beta or worse pass babes from my race. Woman na woman. All de good tins and de bad bad tins you go find for ya own race dey for oda people race. Dat one na known fact, I don experience am from both sides.

But my dear readers, make I talk true small..., some kind differences dey sha! Especially de kind way wey una go dey interact. First of all una culture different. Ee get de kind tins I fit tell Naija or black babe and she fit relate to, but if tell onyibo babe she no go understand at all, ee go dey like say na foreign language I dey speak.

Anoda tin na say babe from anoda race wey like you dey usually spend plenty time to learn about ya culture, to her na one way to show you say she really like you. And trust Naija boys, na dat time we go begin sugar coat everytin for her. No be say we plan to lie to her, but we dey make sure say na only de good part of awa culture we dey tell her..., because why..., we wan impress her too!

Na dat time you see as we dey spend time online to show her all de good stuff we wan her to know. If you see any bad tin you go tell her say, 'well dat on na tey tey, or you no come from dat side of Naija'. Sharp guy no wan make de babe leave her onto say she don begin fia.

Anoda true confession be say guys wey date outside dia race dey take style dey more well..., ROMANTIC with de babe. I fit dey wrong for dis one, but na wetin I dey observe. Mutual respect between una dey usually dey high, may be na because each pessin dey conscious of de oda pessin culture. Nobody wan cross any cultural lines.

But how outside people go look una be different mata! As far as me I know, interracial dating for yankee no too dey acceptable. Some people fit tolerate am, but still most people no too like am. And dat one dey true with onyibo people. Some of dem no too like to see WHITE/BLACK dating or racial mixing as some dey call am.

Na so una go dey mind de kind places wey una go dey go. Una go first check out restaurant before una enter. Except you dey for big cities where everybody dey mind dia own business, some kind club or bar na no go area for 'mixed' couple. De kind eye wey some people go dey look una go just make you dey very uncomfortable. Some foolish people fit make comments wey una go hia wey no too dey friendly.

And before una decide to attend any family gathering, na so una go rehears or check out who and who go come so dat una go know weda ee dey ok to bring ya date to de occasion. And I go tell you dis one, no be very good feeling to attend family occasion wey people dia no really want you around sake of say you no dey like dem.

And if una gree to marry, dat one na anoda giant mountain wey una get to cross be dat. De wahala for dat one dey make most guys to fail liver and decide to be 'just friends' with de babe. And unfortunately na de babe dey usually get mind pass when ee reach dat stage. When woman don put her mind for sometin she dey usually mean am. Only few guys don ever cross dat bridge.

I wish say de world no dey look people too much sake of wetin dia skin color be. But de reality be say awa world no dey color blind. But color dey determine almost everytin, especially for dis side of de world. Me personally no see anytin wey dey wrong with interracial dating. If you get de mind to do am, WHY NOT!

No comments:

Post a Comment

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...