CHRISTMAS FOR YANKEE NO DEY SWEET

Boooooorrriiiinnnggg!!!(for Mercy Johnson voice). Nna men, Christmas day for dis place dey like house arrest oo! No be small tin! Na so everybody dey indoors dey celebrate. Nothing much to do than to sidon for house dey chop and drink. 

Make you forget dos Christmas movies wey una don watch oo! Dat one na film tricks. Yes tins dey fine outside during Christmas. Decoration dey plenty everywhere, lights and colors everywhere. But, as per flexing, nothing much dey happen for Christmas day.

If you get luck, pessin fit invite you to "come over" for im house to hangout, otherwise you dey on ya own oo. Ee dey pain pass if you just arrive yankee new new. As you still be JJC, na so you and ya couch or bed go collabo and do Christmas together.

Chai, I remember my first Christmas here, na so ee dey me like say world don end. Nobody dey pass for road, most stores and offices dey closed. If you no buy wetin you need for 24th, sorry go be ya middle name. Na so I dey inside house dey watch TV sotey I tire.

But as time come dey pass, and I come dey make friends, especially with Naija and other African people dem for my area, de tin come dey beta small. We go plan in advance to meet-up on Chritsmas day and celebrate as a group.

Each pessin go bring sometin wey we go chop or drink. Den we go choose pessin house wey we go meet for de party. If not like dat, hmmm... na so all of us for dey suffer in-silence oo! Den some of us wey be foreigners fit get luck and de onyibo people wey like us fit invite you for Chritsmas dinner for dia house. Dis one na real priviledge ee be oo!

Ee come dey remember me as ee dey be for Naija for Christmas day, who dey even dey house say im dey celebrate, where places plenty to go catch cruise? Especially if you dey village, na im be say na jolification till day break. Even for town, plenty gbedu places dey wey you fit visit sef. Na you go even tire sef.

Una wey dey Naija, una take style dey enjoy oo! Make una no dey tink say na heaven wey we dey hia oo. No wonder wey most Naija people for abroad dey travel back to Naija to celebrate Christmas. I swear some kind tins still beta for Naija pass for hia. Christmas na one of dem. 

Dis house arrest wey we dey do hia say na Christmas celebration, no be am at all. Abi na de cold wey dey for December? How you wan even begin move around for outside fro de cold sef? Highest tin you fit do na to drive around downton to dey look lights and decorations. Wetin be dat one sef? Mtchewww!

Anyway sha, as you dey celebrate, weda na Naija or na abroad you dey, make you always remember de reason for de season. MERRY CHRISTAMS TO ALL OF UNA.



DOWNLOAD THIS E-BOOK: https://www.amazon.com/dp/B09RJW7QNR

1 comment:

  1. I just dey laugh.......I dey always love your post.

    But e don tey wey you post wetin happen?? Merry Christmas sha.

    ReplyDelete

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...