MY YANKEE FRIEND NO GO LET ME REST

Dis people no wan let me rest anytime dem come my house when I dey cook. Na so I go dey hia tins like- wetin be dat? Na wa oo..., wetin die for ya house? Wetin be dat tin wey you like to cook wey dey smell like rat wey don die for long?

See me see wahala oo! How wetin I dey cook for my own house come dey concern dem like dis? Anyway sha..., de tin wey dey worry my friends nose na my crayfish and dry fish wey I dey use cook. Dis na sometin wey no dey common hia. Even sef, most people hia no even know say you fit dry fish.

Anytime pessin wey I know travel to naija, I dey always get plenty supply for soup tins. Me I like to cook naija food for hia. Dem fast food no dey gree master my body.

But my friends dey always like my food anytime when I cook am finish. Dem go chop and almost lick plate. So de tin dey surprise me as dem no fit stand de smell of crayfish and dried fish.

Well me I don dey use to de smell sotey ee no dey even enter my mind say dis tins get bad smell. and me I no get any plan to stop to use dis tins when I dey cook. My yankee friends just need to adjust dem nose to de smell of my ingredients oo!!

3 comments:

  1. Hellooo?
    it's being a while...how are you doing?

    ReplyDelete
    Replies
    1. My dear I dey fine oo! No mind me, na laziness been dey worry me. Hope you dey fine?

      Delete
  2. the thing no dey smell na abi as a 9ja my nose no dey work when e come to those ingredients?

    ReplyDelete

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...