TRANSGENDER PEOPLE

No be small tin oo! Pessin wey God create finish, go look im sef for mirror den decide by im sef say God been make mistake to create am as man or woman. Den dat pessin go use im own hand come change im sef to anoda tin. Cold catch me for dis one!!

I tink by now everybody don sabi say for yankee, de tin wey dem claim say dem get yanfu yanfu na say everybody get de freedom to do anytin wey dem like, unless say dem no break any law. But if you don live for dis country tey, you go sabi say dat talk about freedom no be as dem dey talk am.


Anyway sha, back to de transgender mata..., no be like say I get de right to judge wetin anybody decide to do to im body, but wetin dey worry my mind na de fact say de tin just dey against nature. And no mata how many tins you change for ya body, ee get some tins wey go remain and wey go constantly remind you of who you originally be.

All ya old photo go always remind you of who you really be. Maybe you go burn all ya aphoto dem and den go try delete all de ones wey go dey for cyberspace!! So no mata how you try, ya past go still dey dia dey look you like mirror.

And na dat time dat pessin go begin suffer from CONFLICT OF PERSONALITY. Wetin all dis people wey dey support dis lifestyle no go admit na de psychia side of dis mata. Most of dem dey get wahala for dem mind. Na so you go constantly dey fight with ya mind to decide wetin you really be.



MAKE UNA STAY TUNE....!



4 comments:

  1. i like this ur blog wella...........e dey sweet me for belle as i dey read every every wey u post........

    ReplyDelete
  2. i like this ur blog wella...........e dey sweet me for belle as i dey read every every wey u post........

    ReplyDelete
  3. i like this ur blog wella...........e dey sweet me for belle as i dey read every every wey u post........

    ReplyDelete
  4. i like this ur blog wella...........e dey sweet me for belle as i dey read every every wey u post........

    ReplyDelete

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...