YOU NO FIT SEND ANY SMALL PIKIN MESSAGE FOR YANKEE

You know..., sometimes ee get de kind of tins wey you see or experience around you for dis yankee wey go make you miss naija. Some kind tins wey you fit do or say for naija and no mean any tin, but if you do am for hia, ee fit land you for serious wahala.

To discipline pikin hia na no no. No even tink am! Even sef, you no get right to discipline ya pikin de way you want. If you do dat one, na im be say na police attention wey you dey find. I know some parents wey dey even fia dem own pikin wey dem born.

Dem go prefer to padi with dem pikin, instead of dem to make de pikin understand de difference between papa/mama AND pikin. Even to send pikin message na problem. Ee get women for hia wey dey do everytin for dem children. Dem go wash dem cloth, wash plate wey pikin use eat, clean dem room etc.

I know of some students when I been dey skool, wey go carry dem dirty cloth go back house for weekend for dem mama to wash for dem. Some students no fit stay two straight weeks for skool. Dem must go back to dem house every weekend for dem mama to do tins for dem.

Me I been experience sometin for de first week when I been enter dis country. I been dey for my uncle house for de first two weeks when I enter yankee. I remember de time when I been send my small cousin message, and de girl just roll her eye and den come tell me to do de tin by my sef.

I been tell her to give me wata from fridge, and de small sisi yankee just give me dat Welcome To America shocker. Afta dat shocker, I remember wetin my broda been tell me. Him tell me say guy you no dey naija again oo, for hia you go do everytin by ya sef.

I go tell you dis one..., ee take me sometime before I fit adjust to de fact say tins dey different for hia. Just because say you senior pessin no mean say you fit tell dem wetin to do. If you no wan any insult or disrespect to reach ya side, you go just get to maintain ya own lane.

2 comments:

  1. See ehhn if I be oyinbo ehhn and I know say. I no go. Fit discipline my pikin dem the way I want for yankee, na simple thing, I go carry them go another country, that is we go relocate to another country!! Dey live for there.... make I see as dem wan take misbehave!!! Their Fada..... lol

    ReplyDelete
  2. I go carry that pikin come 9ja, when i finish with am em eye go clear. Who born monkey ? u know waiting my eye see for my parents hand? when i go send my pikin em go tell me to do am myself, that pikin go pay em sch fees and feed em self by em self.

    ReplyDelete

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...