TO MY SISTAS FOR YANKEE (follow up)

I been read dis blog post wey @NewDawn write. For de post she been dey discuss how one Naija babe take dump one Naija guy wey her pastor introduce to her. Wetin be her reason? De guy no be wetin she been dey expect am to be. Basically, she mean say de guy no reach her level.

Well..., everybody get dem right to marry OR no marry anybody. Na dem right and I gree with dem for dat one. But wetin no sweet my bele about de whole post na de analysis wey @NewDawn been try to give for why de babe dump my guy.

De guy be dokita for Naija, but de babe tink say him dey practice for yankee, and den when she find out she bounce. De analysis be say she no wan carry de guy money mata for her head. But according to de tory, de guy get im small job wey him dey do, so why him go need de babe money to survive?

Anoda point wey I see for de post be say she no wan to suffer to pay for all de exams wey de guy go need to write for am to qualify to practice as dokita. Well..., from experience, any dokita wey come yankee and struggle to write and pass dis exams dey finally find beta work and den hammer well well. So I no understand why de babe no fit stay with de guy and encourage am to get him license.

Last last, both of dem go enjoy de guy money when him begin hammer. But what if de guy no come hammer, what if de guy and her just dey live regular normal life, without too much money? Wetin dey wrong with dis one?

Dis one come remind me of one of my BLOGPOST. I been write as most Naija guys dey complain as ee dey hard for dem to fine Naija girl wey dey ready to marry. Dis one na serious mata for here oo! Most babes go begin form for you or dem go begin give you levels ones dem find out say dem dey make money pass you. Everytin here get dollar value oo! Nothing like "make we work am out together with patience until we make am".

If person attend any Naija occasion, na so you go see plenty single people with beta jobs and dey do well for dem sef. De guys dey run from de babes and de babes dey complain say marriage no wan look for dem side.

Well..., if babes continue to dey look for de guy wey get everytin wey dem dey find, na im be say dem go wait till "thy kingdom come!" No wonder once most guys for here don finally make am, and wan to settle down, dem dey run go back to Naija to find wife.  And I neva here dem complain say dem get to bring woman from Naija come yankee, take care of her until she find work, or complain about her skool fees (most times she get to go skool to get some kind certificate).

Most men no get time to dey complain. All dem want na woman wey go helep dem start family. And I expect awa sistas wey don make am to no over tink say any man wey wan marry dem dey come to chop dem money. Most guys wey leave Naija to come yankee already get hustling spirit for dem body. All dem want na woman wey go encourage dem achieve dem goal.

No get me wrong, I understand de fear wey some babes get. Some guys go dump dem afta dem don helep dem finish. Well dat one no get anytin to do with how much you spend for de guy head. Any guy wey get any sense for him head no go dump babe wey don helep am stand well and born pikin(s) for am.

De absolute truth about guys like dat be say, if de babe shine dem eye well well from de very beginning of dem courtship, she go don see de signs say dat guy na 419. But de problem be say most babes go close eye still stay with de guy until ee go dey late.

So de conclusion of de mata be say, make my sistas for yankee no too dey fear to marry guy wey dey interested, no mata if dem get money pass de guy. De only tin dem suppose do na to shine dem eye and know guy wey get potential and dos wey be proper 419. Every Naija babe fit differentiate both of dem. Na talent wey God don already give una (every Naija babe already get over sense fordem head, lol!).

No comments:

Post a Comment

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...