HOUSE HELP

"Cleaning help wanted, must be able to work independently", "nanny wanted urgently". Dis na some of de adverts you go dey see for newspaper or for websites like craigslist. For here, if you need house help, you no go just carry person pikin as we dey do for Naija den come make am to do all ya housework.

You must specify de kind work wey you wan make de person to do. If na to clean ya house, look afta ya small pikin, or to clean ya compound, you go find person to do dat work for you. And everytin for hia boil down to one tin-money. Dis one go depend how many hours or days de person go do de work for you.

If you dey look for person to look afta ya small pikin, you fit hire somebody for some hours or you fit carry am go daycare and pay de people wey dey run de place. If you need somebody to take care of ya old mama or papa, you go employ somebody wey go come ya house everyday to look afta dat person. Month end or weekend, you pay de person im money.

De house cleaning tin dey popular with most people wey no get beta education and need work to survive. You call dem, dem clean ya house and you pay dem for de number of hours wey dem work for you. and you need to dey very careful with who you call to clean ya house. If not na so ya tins go begin miss.

Why de regular house help tin no fit work here be say, de law for here say every skool age pikin must go skool. No story, no excuse. And so if you keep person pikin for ya house wey suppose dey skool to dey look afta ya own small pikin, na you and government go wear one trouser. Child abuse here no be joke, and dem see dis kind behavior as child abuse!!

Ee get anoda kind of special arrangement wey you fit "employ" somebody to work for you and you go pay am with feeding and boarding. Dis one mean say you go provide food for de person and place wey im go sleep. People wey get big farms or big compound wey need constant cleaning, fit find somebody wey go helep dem take care of dem place.And most times de arrangement go allow de person to go find anoda work wey imfit make money, so long as say im dey take care of de compound or farm for you.

De kind arrangement wey person go work for im "master" for some years and den im master go come "settle" am, dat one no fit work here. No be say ee dey illegal, but de way people eye dey chook for money for dis place, nobody go gree work for anoda person for years and den wait for "settlement". For here, everytin na cash and carry. If person work for you, im expect payment immediately.

But foreigners still get house helps like we dey do for Naija. Like de asian people, dem dey go back home, bring somebody to come helep dem for dem business, or for dem house. Dem like to only "employ" people from dem place. Dem go tell you say de person na dem sista or broda. Dem go dodge to pay tax or dodge to tell government how much dem dey pay dia workers.

No comments:

Post a Comment

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...