ME AND MY BICYCLE

"Are you ok? Do you need any help?". As I hear dis quesions and come turn around to reply de person wey ask me de quesions, him and de woman wey him been stand with just rush enter dem house. Wetin just happen? I stand dia like person wey see ghost. I still dey try to figure out de drama wey just happen.

Na afta I come yankee wey begin like to ride bicycle. Well..., I really no like am like dat. De tin start with de situation wey I been find my sef. When I been dey skool and I seriously need transport to and from my classes, but no get money to buy moto or enough money to enter bus or taxi, I come decide to buy bicycle.

See me wey no even get bicycle for Naija. I no know de last time wey I ride bike for Naija. Awa roads no dey good to ride bicycle. And de way we dey drive moto, I no go advice anybody to begin ride bike.

For de skool wey I been dey, plenty students get bicycle. Most people wey dey live near skool like me prefer to ride bicycle to class. Ee dey cheap to maintain and you fit ride am enter any where around campus. My bike really helep me to move around, and to me na de best transportation on-campus.

But de accident wey fit happen to you with bike no really occur to me until dat my encounter with de person wey ask me dat quesion- "are you ok? do you need any help?". Na one funny and painful experience wey I been I no fit forget.

Dat day I been ride down one street like dat. De road for dat street get very sharp slope. And as I dey come down de hill, I loose control of my bike. Dis na road wey I don follow plenty times. But dis day, I been ride with excess speed tinking say I fit control my bike as usual. Dat one no happen like dat!

As I begin reach de middle of de road, I discover say my speed don dey too much. Den I come make big mistake..., I press my front break too hard!! Next tin, I turn to "superman" for like...,may be 3 seconds. As I dey turn for air, na so my bike dey fly follow me. I land with my hand, den with my back. I do like 5 or 6 quick summersaults.

Like say dat one neva dey enough, my bike wey still dey do im own tumbling, come finally land for my body. I no wear any helmet, no protection! De rough road peel my palm. De wound dey deep well well and I fit see my white meat. With all de oda bruises for my hand and leg, I just tank God say I no hit my head anywhere or break any of my bone.

De stirring for my bike bend go one side. But dat one no too worry me. I dey more interested for my body. I still dey check out my cloth and leg and hand to count all my wound, before I hear dat voice. I see dis onyibo man and de woman wey him been dey with begin rush enter dem house.

Wow...! You just ask me weda I dey ok, and you dey run dey enter ya house. Which kind people be dis one? So if na mata of life and death, na so dem for run enter house leave me for here? If I tell you say cold no catch me afta I see dis one, na lie I dey lie.

Well ee no take me long to realize why dos people act like dat. Dat street wey I been dey na "exclusively white". Den me and my color come get accident for dem "zone"! Most tins here na "black OR white oo"! Sad, but na de cold truth. And no get me wrong, some onyibo go helep you when you need helep.

But some..., old habits dey hard to change. Wetin person go do? Well..., ee get tins wey you no fit change. You just get to live with de reality wey dey around you.

I clean my sef, pick up my bike, waka jeje dey go my way. I go de skool clinic, treat my sef,and continue to ride my bike. I still dey ride bike till today, and I dey try to dey more careful now!!

No comments:

Post a Comment

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...