MOONSHINE, OYIBO PEOPLE KAIKAI

Me and drinks sef, we dey like five and six. Na beer be my drink. Any day any time, na beer I prefer. Sometimes I go drink wine or hot drink. I no too like dis ones. Wine or hot drink dey shack me quick quick. All my friends know say anytime I wan drink, na beer be my choice of "poison".

Guilder be my friend for Naija. "The ultimate" and me dey like five and six. If guilder no dey den I fit go for Star. But as Guilder or Star no dey for yankee and person get to drink beer, I dey "manage" de brands wey dem get here. Most of de beer here dey like wata to me, lol. De tin no dey enter my body like my Guilder. Infact I dey drink am like say na wata I dey drink.

No mind me oo! Alcohol no too good for person body. I know dat one. But I believe say everybody get wetin be dem own vice, and my own na beer. I dey try to no drink too much and come begin miss yan or stagger anyhow. Beer na my own way to cool down my brain afta a "hard days work". Person get to cool down im stress somehow, abi?

Like I talk before, anytin wey no be beer no too dey good for my body. I realize dis one again last weekend when I been drink one kind drink wey dem dey call moonshine. Dis na yankee people dem own KAIKAI. dem dey make am with corn. My friend bring out dis bottle wey contain dis tin. Him tell us say im bros brew am and say de tin strong well well.

For my mind I tink say na just regular home brewed wiskey. But when I test de tin, ee dey like say my body dey on fire. Dis tin dey very hot, de tin burn me from my mouth to my throat and down to my belle. De tin really SHINE my body. Dem ask me to do anoda shut and I tell dem no (for my mind, I tell dem "shey me una wan kill abi?").

I say eh..., dis tin strong to de point wey de odor from ya mouth afta you drink am fit catch fire. Even to make am dey very risky. If de place wey you dey cook am no get enough air to circulate, ee fit explode because of all de vapor wey go dey de air.

I don dey hear moonshine for long, but nothing prepare me for de experience wey I get when I taste am. De drink strong well well.

No comments:

Post a Comment

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...