WINTER DON COME AGAIN!! part 2

Part 1

When de wata for de pipe don block, de next tin na to break de pipe. And to stay without wata during winter no be wetin anybody wan joke with. So to avoid dis one, you go open ya tap small so da wata go continuously dey flow. Dis one go stop de wata for pipe to form ice block.
 
For de past three days, de cold for here no get part two. De kind snow wey don fall for some states plenty well well. Place like New York don get snow for dis three days wey dey equal to de kind snow wey dem dey get for de whole winter season. We for Texas dey lucky say snow no dey fall too much.

In fact, snow dey hardly fall for Texas. Anytime wey ee try fall na so people go dey behave like say manna dey fall from heaven. Children go dey play with de snow. Some go build "snow man", odas go mold am like ball dey stone each oda.

I remember de first time wey I see snow. Na one of de days wey I no go eva forget. I dey for library dey struggle with my books as usual. And den I come hear as people dey shout dey run comot for de library. Den my reading partner come point outside to show me wetin dey happen.

Dis one na my first time to see as snow dey fall from sky. Me and my partner stop to read, so dat we fit go outside to see de snow. As I step outside and den look, I see dis small small white tins wey dey like cotton wool. As I look up na so more dey fall.

Den I enter inside de snow, open my hand to fetch some. De tin just dey light like foam from soap. De snow don come begin plenty for my shirt. To see as de tin dey fall for my cloth dey very cool to watch. I just dey watch as each of dem dey fall with slow motion before ee land  my body. I say eh.., I spend like five minutes dey watch dis tin, lol. If no be say cold come begin enter my body, I for stay dey enjoy my first snow fall experience. My thick jacket been still dey inside de library.

I dey see snow for TV when I dey Naija, and now I dey see de tin for de first time. I no go lie you, na dat day wey I see snow for de first  time wey I really feel like say I really dey for yankee.

I later join odas to play "snow ball fight". And den when I reach house, I try join some people to build snow man. Every year, we dey look forward to de two or three days wey we go get snow for Texas. But last year I been visit Ohio state to see one of my friend. De snow for dia just dey too much.  De tin dey cover house and road. We come decide to go do SKIING for one place like dat.

Na one experience wey I enjoy but fear me at de same time.....,


TO BE CONTINUED...

No comments:

Post a Comment

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...