TO MY SISTAS FOR YANKEE

My sistas, how una dey? I hope say everytin dey go well for una side? Well we tank God. Abeg ee get one serious mata wey I wan discuss with una. De mata concern bros dem. Dem carry complain come meet me. Dem say dem don begin tire for una, and say most of una no dey easy to approach oo!

I come dey wonda why ee be like dat. Why una dey make bros dem tink dis way naw? Guys say una too dey give dem levels. Most of una no go wan follow dem talk at all. I hope say una neva begin believe dat nonsense wey akata babes take full dem brain? Dat rubbish wey dem dey call “strong independent black woman”!

I know say una no suppose lower una standard. But wetin most of una need to know be say any guy wey fit make to yankee get serious potential to make. Naija guy no dey eva carry last for anytin. Ee go take time for am too make am, but him go make am finally.
 

My sistas, if ya plan na to find husband, you need to package ya sef different from all oda type of females for dis country. Ya best marketing strategy na to arrange ya sef like typical Naija woman go behave if she dey Naija. You must show say you dey very family oriented oo!

Dat “I be career woman” type of nyanga no go eva work for you for dis country oo. And if you be dat “I be sophisticated, high class, over-achieving, no nonsense” type of babe, no be you I dey talk to. I dey try reach out to dat Naija babe wey just wan enjoy life as a regular MARRIED WOMAN.

Shey dem say if you dey for Rome, make you behave like de Romans? Well dat one fit work for some tins. But I no know weda dat one go work when ee come to marriage partner. De tin be say de “Romans” for dis country no go eva accept you as one of dem, and I dey sure say all of una know dat one.

Wetin be de chance say onyibo go marry you, or akata go marry you. And wetin be de chance say una go understand una sef well well and de marriage go last. You no see as dem Indian and Chinese people dey do. One minute dem enter yankee, dem don hook up. No do no do, dem don marry. But awa own no be like dat. We no dey ever mix. Everybody dey form, and some dey try very hard to hide dem identity say dem from Naija.

My sistas make I tell una dis one, na two main tins dey an average Naija guy mind for dis country. Number one, na to get beta job, and number two na to settle down and start him own family. And weda sistas know dis one or not, every Naija guy first choice na Naija babe. So make una begin make una sef accessible and available oo! So dat most of dis awa bros go stop dis arrangee marriage tin and do de real tin once and for all ( I dey sure say una know exactly wetin I mean by dat one…..!) lol.

Nothing go make a typical Naija guy change him mind quick quick pass when him see where Naija babe dey behave like a typical yankee babe. So mind de way you behave around de Naija guy wey show interest for you!

My sistas make una reprogram una sef oo! Most of una don comot for where network coverage dey!!

Dis write up too na for all de oda Naija babes wey dey oda foreign countries.

If you need to know more about how to position ya sef for dat guy wey need wife, stay tuned for my ebook wey I go publish SOON!!

So my sistas, una agree with wetin de brodas talk?

No comments:

Post a Comment

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...