BROWN, GARNER AND OBAMA DAUGHTERS

Nobody wey dey live for dis country go say im no notice de tension wey don dey go on for one week now. No be news say korofo and citizens no too dey friendly for dis country, especially between korofo and akata people. Almost everyday, you go hia complain of bad tins wey police don do.

And for de past seven days, tension just dey grow for most part of de country. People dey protest wetin don dey happen for missouri and new york. For de place wey dem dey call ferguson wey dey missouri, one olokpa (darren wilson) shoot one boy (Michael Brown) six times, leave im dead body for road for four hours. And de case don dey on since august. Den last week, de grand jury come out with dem judgement- NOT GUILTY!! Say de police man no do anytin wrong.

I no be lawyer and I no wan claim say I know how de criminal system for dis country dey work, but to say police man get de right to shoot teenager wey no hold any weapon, for broad day light just tire me well well. And protest don dey go on for ferguson and around de country for one week now. Anytime wey I turn on my TV na de only news wey person dey see.

Like say dat one no dey enough, for new york, anoda grand jury don free anoda police man (daniel pantaleo) wey kill Eric Garner. Dis one na man wey one police guy choke to death. And dis incident wey somebody videotape just dey very hard to watch. How dos people wey dey de grand jury go decide say dis police man no dey guilty of anytin just dey too hard to believe.

Or na de one wey police do "drive by" shooting wey kill one twelve year old black boy. Somebody call police and tell dem say she see one boy wey dey play with gun for de play ground around de area. Police drive come dia, two seconds afta, dem shoot de boy two times. Den dem come find out say de gun na toy gun. Twelve year old boy dey play with toy gun, two seconds afta police meet am, de boy don die.

Na only person wey no get conscience go see de way police dey shoot people like bushmeat and no go feel bad about am. As I dey type dis one, protests dey go on for different part of de country. People don tire for de way police for here dey treat dem citizens, especially black people. Nobody say police no get to do dem work, but de way wey most of dem dey behave just dey unacceptable. Some of dem dey act like say na war front wey dem dey.

Den de tory about dat clown wey go dey attack Obama daughters. No be only say de stupid woman attack just dey girls, she attack dem parents too. And I dey happy say de mumu don use shame resign from here government wok afta people begin attack her for her stupid comments. But wetin come dey shocking about dis tory be say, de woman wey dey attack small girls get her own smelling skeleton for her cupboard. To find out more about dat skeleton, make you CLICK HERE

And den with all de news about de women wey claim say Bill Cosby rape dem 20 or 30 years ago!! Dem no talk about am when ee happen, but just decide to come out now? De case dey too complicated for me to begin comment. We go just fold hand dey watch as everytin go take end.

No comments:

Post a Comment

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...