OVERWEIGHT

"I no know as una dey do am for Africa, but here for yankee, make you no eva tell woman say she get body". Dat na wetin one babe tell me. I remember most of my intial yans with babes for yaknee. I dey always notice say we no dey too understand awa sef. Some words wey I go use fit mean totally different tin to dem. Na so I go dey explain my sef or begin use oda words wey I feel say dem go understand, lol.

So after I tell dis babe say I like as she get body, ee nearly cause sunami between me and her. Yes oo! Dat day I learn my biggest lesson of wetin you no suppose ever tell babe for yankee. For here, ee dey almost like blasphemy if you tell any woman about her big size or weight. Dat one na no go area. Some women fit divorce you if dem be ya wife, lol.

For yankee, body weight na very serious issue, especially for women. Everyday, TV and movies dey bombard you with de idea say "slim fit" be de perfect image of woman wey fine. Na so dem go dey flood us with news about de new surgery wey dis or dat celebrity do to reduce her weight. And as celebs for here dey like GOD to most people, dis "slim fit" image get millions of believers.

Dis one don make plenty people to suffer from de sickness wey dem dey call bulimia click here. Dis disease na serious problem for most women, especially teenagers and babes wey dey dia early 20s. Some dey even go as far as to dey chop cotton wool. Yes, de cotton wool wey you dey take clean wound. Dem believe say ee dey helep dem to no dey hungry.

Businesses dey make billions of dollars every year sake of say over weight na bad tin. You go dey see commercials about new and improved drugs wey go make you loose weight fast fast. Or new exercise machine wey go helep you burn calories quick. Or de TV shows wey go teach you how to loose weight. De tin no get limit.

But wetin dis businesses no go wan tell dem customers na say body weight dey connected to wetin enter ya mouth. Like for computer, dem say na "garbage in, garbage out". De food wey you dey eat go determine how big or slim wey you go be. And for dis society, dem like food oh..., no be small.

Restaurants full everywhere, and people dey hardly cook for dem house. And most of de food for dis restaurants get plenty calories inside. Everybody dey drive for moto wey get AC and so all de calories go just attach for ya neck, ya belle, ya manchester and ya ......!

I know say for Naija we get fat people, and most of dem fit carry dem sef. But for here, ee get some fat people wey you go see, na so you go dey shake head. "Shapeless" be de word wey you go use describe dem. Na so fat go dey hang for parts of dem body wey you no ever expect to see fat. I don see people wey dem belle dey almost touch dem knee. And na dis kind people dey eat fast food morning, afternoon and night. No be small tin.

No be say I dey write dis one to make fun of people wey fat or to yab people wey too like food. But I believe say wetin suppose mata to anybody na how ya weight dey affect ya daily activity or ya health. If you dey healthy with de size wey you dey, you no get any wahala. Anoda person size no suppose be wetin you need to use mearsure how fine or ugly wey you be.


Beauty dey for different sizes, weight and shape. Some like slim, some like tall. Some like short, odas like fat. As for me, I like babes wey get enough cushion for de right places!

Which one wey you like?


No comments:

Post a Comment

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...