DO AM YA SEF

For here, to do any kind repair for ya house no be small money. No mata how small de work wey you need to do dey, dem go charge you plenty money.

So dis one don make plenty people to decide to dey fix anytin wey spoil for dem house by dem sef. Wetin most people dey do na to go online go watch videos of how to repair dat tin or dem go buy do am ya sef books.

Some people dey repair dem own moto, repair any furniture wey break, change de roof for dem house. And if you get de liver you fit fix any electrical work for ya house. And why most of dis tins dey possible na because say dem get plenty stores wey you fit buy any kind tools wey you need. Dem dey call am hardware store.

Dis stores dey very popular around America. And ee don make am possible for plenty people to decide to work with dem own hands. I don even see where person build him own house from ground up. Na simple house sha, but him build am well.

Abi na to paint house? Almost everybody dey do dat one by dem sef. De paint wey you buy dey usually come with instructions of how to use am. Almost everybody dey cut de grass for dem compound. Wetin you need na to go buy ya own mower, push am around or drive am, depending on de type wey you buy.

And if you look for TV, you go find channels wey dem own na to teach people basic skills of how to repair tins around dem house. Dis TV stations dey very popular.

Well..., dis do am ya sef tin come interest me too. I begin fix small tins wey spoil for my car. I learn how to change oil. I begin change oil for my moto. I also watch vidoes and come learn how to change break pads. Na de back tire wey I change, de front tire dey too complicated and I no wan risk dat one.

Den I come decide to learn how to change spark plugs. Now for my mind I don begin believe say I be mechanic. But wetin come happen be say I no "pass de exam". When I change de spark plugs finish, for my mind I don do solid job. De moto start and everytin be like say ee dey perfect. But na de next day I come realise say I really mess up for de job wey I do.

I no realise say I switch de spark plug wires. My car come begin miss fire and dey do stop and quench. Next tin, my wata pump kpafuka!!! No be small tin wey I see with my eyes. De tin come finally cost me plenty money wey I no plan to spend. Na den I come realise say do am ya sef no mean say make you spoil am by ya sef!!

To fix tins by ya sef dey very exciting. Especially when you see dat tin wey you fix come back to life. Ya bele go sweet you well well when dis one happen. But make you try fix tins wey you sabi well well oo! Me I learn dis one de hard way.

No comments:

Post a Comment

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...