MY EXPERIENCE WITH SOME SHOPKEEPERS

Sometimes when I enter some stores, I go notice say one of de storekeepers go waka come meet me, den come ask me “you need helep?”. Me I been tink say dem dey very friendly and sweet with de way dem go always rush come meet me and ask weda I need helep.

Dis tin don happen to me plenty times and I come dey use to am. But for some reason, I notice say no be everybody dem dey offer dis dem special helep. I notice say most times dem no go even look de onyibo people side. De only time dem go speak to onyibo person be when im come to pay, and dem go ask am if im find everytin wey im need.

And sometimes, when I dey some so called “high end” stores, na so I go see one store worker dey try arrange shelf or goods close to where I stand. I go dey notice tins like dat but I no really understand wetin dey actually happen. Den na later ee come clear my eye say na because dem tink say I be ‘poential” THIEF! YES oo, I mean OLE.



For dis country, dem get one serious stereotype (dat stereotype tin wey I been don talk about before) say black people too dey thief tins when dem enter store. Weda dis one na lie or true, me I no sabi. All I know be say na every race wey I dey see for TV and news paper wey dey involved for shop lifting. But why be say na black people dem dey put eye for dem mata pass?

Anyway sha, de tin come take style dey vex me somehow. Afterall, almost every store for yankee get cameras everywhere and dem get TV monitor wey dem fit dey watch and see who dey thief. Why dem get to dey follow person for yansh like fly?

And even when dem come ask you to accept dat dem yeye helep, you go notice some kind aggression for dem attitude. You go even begin wonda weda na by force say you must accept dem helep, lol. For my mind I go dey like “you no go carry ya stupid sef comot for my road, so dat I fit take time find wetin I want?”

So now when dem offer me dat dem aggressive helep, I dey take dem do yeye. Na so I go carry de person waka round de store. I go begin ask am for tins wey I no even plan to buy. Na so dem go dey waka with me round de store tire. Den when dem ask “any oda tin?”, I go come pretend like say I just remember sometin. Den we go come go round again. Lol. Some go catch up say I dey take dem play. Den you go see as dem go excuse dem sef come run 440!! You for stay dey ask me yeye quesions!!!

No get me wrong, for some stores, you go meet very nice storekeepers. Dem know when ee dey hard you to find sometin wey you wan buy. And de way dem go approach you, you go see de politeness and how genuine dem dey. I appreciate and respect dos ones.

But dos yeye storekeepers wey dem job na to harass you up and down for de store, I no like dem at all. Anytime I encounter dat type, na de last time wey I go ever enter dat store!!

Wetin be ya own experience?

No comments:

Post a Comment

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...