AMERICAN SKOOLS


I know say de common belief about skools for yankee na say dem dey very expensive. And some tink say ee dey very hard to gain admission. Na true say some skools for yankee dey very expensive. Even to gain admission fit dey very hard.


But de tin wey most of us no know be say dem get oda plenty plenty  skools wey dey very cheap. I mean skools wey regular person for Naija fit afford, and skools wey cheap pass some skools for Naija . Why people no know about dis one na because of lack of info.


If you get access to internet, phone and post office, you fit gain admission to very cheap quality skools for yankee and Canada from anywhere for de world wey you dey. You no need any agent to helep you get admission. De steps wey you suppose follow dey very straight forward.

You need to know wetin you wan study, de semester you wan start skool and de type of student wey you be. You fit start as freshman (dat na if you just finish high skool OR you only get high skool certificate), you fit start as transfer student (dat na if you already dey unviversity, polytechnique OR college of education AND you wan transfer to skool abroad), or you fit start as Graduate student (dat na if you don gradge from any higher institution and wan do PGD, masters or PhD).


Any skool wey you dey search for online, make sure say you check wetin dem tuition and oda fees be. If you wan apply as graduate student, find out Profs wey go give you financial support as you dey go skool. Na wetin most graduate student dey take survive.

To find cheap skool, you go need to spend serious quaility time online and search for wetin you need. Me, I study for very cheap skool. I do my masters and na Graduate Finacial Assistance wey I take survive. Cheap skools pelnty, all you need na for you to find am.

You go see all de info wey go helep you well well. You no need to go pay any agent money to find skool for you. Dis book go even guide you on how to succeed with visa application. If ya plan na to study for US, hurry go get de book!

** How many Naija students don go study for countries where life hard dem well well? How many of awa people don die misteriously for some of dis countries sake of say dem wan go skool? Take dis good opportunity wey dis book go offer you and find beta cheap skools for country wey dey safe and where Naija people plenty!!


No comments:

Post a Comment

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...