DOWRY or BRIDE PRICE, WHICH ONE?

I just learn sometin new about de way wey dem dey do marriage for here. De tin shock me well well when I find out about dis tin. I no believe am when I been hear am de first time. So I come ask oda people for confirmation.

No, no be de fact say dem traditional marriage na de one wey we dey call white or church wedding. No be de fact say
 dem no dey do two weddings like we dey do for Naija, and dey waste money like no man business.

When and why we begin make am compulsory to dey do two weddings still dey me very confuse. If de couple insist on christian wedding, wetin stop dem to invite dem pastor to come pray for dem during de traditional wedding for de babe village? I believe say God dey answer prayer for anywhere you dey pray. Abi na de kolomentality wey baba fela talk about still dey worry us?

Any way sha dat one na by de way. De tin wey shock me about yankee marriage be say for here, de babe popsi or family must pay some kind money to de guy family. Yes de girl family suppose pay de guy family some serious kudi.

So I come ask de person wey tell me dis one, "you mean say de girl family get to pay her own bride price?". De chick look me surprise den come tell me say no be bride price but na dowry. Wetin be de difference, all na payment wey must come from de guy family.

Well dat one no be true. Dowry and bride price na two different tins. For here dem decide to choose dowry, money or property from babe family to guy family. We for Naija choose de opposite, bride price. And I come understand why some kind tins no go eva work for dis society.

Like polygamy...., how you wan as a guy go collect money from one babe family and den later decide to collect dowry from anoda family? Dat one no go ever happen, with de kind open eye wey babes here get? No wonda polygamy dey illegal for here.

And den I hear say de wedding reception dey for de babe papa hand. Na him suppose sponsor de tin. But sometimes if de groom wan do am, him fit go ahead. For de ring, each oda go buy for de oda person.

Dis one come make me dey tink. With de kind male centered culture wey we get for Naija and de ova size ego wey average Naija guy get, dis dowry tin no go eva work for us, lol. Can you imagine a whole Naija man to gree collect "bribe"( I know say na wetin dem go call am) from him wife family before dem marry? Some guys no go send, dem go collect, lol.

Anyway sha, dem say different strokes for different folks. for here dem settle for dowry, and we say na bride price. De bottom line be say make de marriage work and make each oda dey happy. Me I prefer bride price. I no know if I go wan collect dowry from my wife family.

Tell me wetin ya opinion about dis one be!!

No comments:

Post a Comment

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...