SEE AS AIRPORT DEY EVERYWHERE

Now wey all man don dey buy private jet for naija, I feel say now na de time for us to build at least one airport for the thirty six states wey we get. So dat all dis people wey we no know how dem make dis dem money fit dey land for any state wey dem dey go. But seriously, I also feel say dis one go make ordinary people waka around naija to dey more easy and fast. People no go too dey rely for moto to travel around.

Just like for yankee, every state get at least two or three international airport. You fit dey for ya state and fly out to any part of de world wey you wan go. And den dem get uncountable small small airports wey dey helep serve local travel. Towns we get population like fifty or sisty thousand get dem own airport. And de tin dey work well. If you wan travel go any big city, wetin you need na to join connecting flight from de airport for de small towns.

All you need do na to go online, buy ya ticket and if you buy very early, ee dey dey very cheap. No mata for where you dey live for yankee,you must to find at least one local airport near you wey go connect you to any where you wan travel go.

And no be like awa Arik Air wey just dey take dem passengers do yeye every time. For hia, if any airline mess up with dem service, na so dem business go end be dat. And as competition penty, na so all de airlines dey try to out do odas to attract more customers. So no time for bad service. Air transport dey very efficient for hia. If you no come on time, na so you go miss ya flight. Dat one almost happen to me once. And unless na weather, dem no dey ever get delay.

And even for small towns wey population fit be like five thousand, dem get dem own tinkili airport. Dis one na for mostly people wey get small single engine planes. Na for dos wey just like to fly for entertainment or where people fit go begin to learn how to fly. Most of dis kind airport get flying clubs where people dey come with dem small planes to practice or just fly. And for hia, dem get almost 2000 flying skools where people fit go learn how to fly plane. And all of dem get dem own airstrip where dem training planes fit land and take off.

Even sef, some big companies get dem own runway and planes for dem to transport dem goods and workers from place to place. And depending on ya levels for de owo (money) department, you fit build ya own personal runway for ya compound. Most of dis big people hia wey no wan wahala dem sef to begin drive go airport, go just fly direct from dem house. Now na dis one wey I dey call LEVELS.

For naija we still dey see air transport as one kind big tin, but for hia ee dey like normal tin. Infact, depending on how early wey you buy ya plane ticket and how far you dey go, ee fit dey very cheap (not to talk of fast and safe) to fly dan to drive or use train.


NIGERIAN NEWS, NIGERIAN NEWSPAPER, OSHIOMHOLE,  OBASANJO, BUHARI, AMAECHI, TINUBU, GEJ, KESHI, SUPER EAGLES, CHELSEA, LARA FORTES, WIZKID, DAVIDO, LINDA IKEJI, DON JAZZY,
JAY Z, OBAMA, JUSTIN BIEBER, DRAKE, CHRIS BROWN

No comments:

Post a Comment

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...