DUMPSTER

De way wey govment for hia dey keep de towns clean, go make pessin appreciate say govment dey really do dem work. For every town, no mata how small wey dat town be, dem get sanitation department wey dey make sure say dutty no dey pile up for any area for de town. Dem work na to go round to collect dutty from every house and office and den go troway am for one central dump ground.

For de apartment wey  dey live, we get dis big dustbin wey dem dey call dumpster. And den every thursday, de sanitation office for the county wey I dey live, go use dia lorry to come offload de dumpster. Every single thursday, dem must come. No delay or any excuse. And na so dem go go from house to house to go collect people dutty.

If you dey live for wetin dem dey call house for hia, dem go give you special govment dustbin for you to put all ya dutty. And when dem come with dia lorry, you must put ya dustbin for near de road for dem to see. And you no need to worry, beacause say dem must come to offload ya dustbin every week.

Every month, you get to pay small money for dis service. And most times you get to pay am with ya wata bill, soak-away and gas bill( dat is if govment dey supply you gas to cook for ya house). And dem no get time to come worry you to pay ya bill. If you wan do ova sense, na im be say ya wata go stop to rush.

Na local govment dey in charge of to collect dutty. Den de local govment/county come share de work to each ward/council. State govment no get any time to collect dutty. Dem get more serious mata to worry about. Local govment dey in charge of to provide basic amenities like wata, collect dutty, education (primary and secondary), road maintenance and oda small small work wey govment need to provide.

No be like for naija wey state and federal govment wan carry everytin for dia head and den go end up to no do anytin at all. For hia dem sabi how to share govment work between de different levels of govment so dat dem fit monitor de work of each level and to know when any particular level of govment no dey do dem work.

And no be like for naija where governor go dig some bore holes or build some kilometers of road and den begin make noise up and down for newspaper say im don deliver dividends of democracy to im people. For hia dem understand basic amenities na exactly wetin im be-BASIC. No be wetin politician suppose begin make noise up and down anytime wey im provide any basic amenity. And na im make no mata how me or any pessin wey come for naija go complain how life for dis place hard, we no get any plan to go back naija. If you see how govment dey take provide all de simple tins wey suppose make life easy, ou no go feellike to go back to go live for naija. Govment for hia dey work.


NIGERIAN NEWS, NIGERIAN NEWSPAPER, OSHIOMHOLE,  OBASANJO, BUHARI, AMAECHI, TINUBU, GEJ, KESHI, SUPER EAGLES, CHELSEA, WIZKID, DAVIDO, LINDA IKEJI, DON JAZZY, JAY Z, OBAMA, JUSTIN BIEBER, DRAKE, CHRIS BROWN

No comments:

Post a Comment

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...