MY CASINO EXPERIENCE FOR LAFAYETTE, LOUISIANA

Last weekend I been go one casino wey dey near my town. Dem dey call am THE BOAT, wey dey for Lafayette for Louisiana. No be my first time to go dia. But ee don tey small since I been go. Casino na place wey I feel say I dey go troway my money..., lol. I neva go dia before den win money. Me and gambling no be friend at all. I feel say why people no dey too win for casino na because for dia beer na free oo! I dey tell you. Drink as you like and spend excess. Lol!


Anyway sha, dis time when I go, I been win small money. But na afta I don play for long time. Me I no dey go near dos black-jack tables. Na for de big fish dem. Na de slot machines I dey anchor, plenti types dey to play with small money. And whenever I go casino, I dey stay till de next day, den begin come back house around 4 o'clock for morning. 

When I play small, na so I go begin waka to go see different tins. Na so I go waka enter de shopping mall, just to do window shopping. Dis time when I go, I discover say de town been dey organize carnival. Different musical bands, drinks brekete, different different food stands with assorted types of food; from seafood to fry fry food. Na you go chop and drink tire, dis na because say for carnival food and drinks dey cheap small.

And when ee don dey dark, nightclubs go begin full. Different types dey; cowboy club, strip club, bikers club, blues club, even same-sex club dey (hmmm.....). Me I go just choose two or three and spend small time for each one. See eh, you see oyibo people, dem sabi organize enjoyment and cruising. Nothing like say I no see where to go enjoy mysef, anytin you dey find you go see.

And na so hotels scata everywhere. Accommodation no be problem at all. And all dis enjoyment spot dey for one area wey dem dey call downtown(de business area of any town). Day-time na for office workers to go work, and night-time na for entertainment to start. 


Me wey na casino carry me come, I don even take style forget dat one. Too many tins wey fit distract you dey happen at de same time. My favorite na de buffet restaurant. Omo, de place na to chop and kill yasef. With only $25 wey you pay, you fit chop till infinity, but you no go carry any food comot. Wow... just imagine any type food restaurant food, ee dey dia.

Afta all de waka waka and flexing, na time to house. I come by 3:00pm stay till 4:00am de next day. Omo, with de kind enjoyment wey dey, na so ee go be like say time dey fly. But man must go house go rest, money to go rent hotel no dey oo. Ee dey expensive sha.

1 comment:

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...