MY FUNNY TRAFFIC LIGHT EXPERIENCE

My hurry hurry and ova sharp guy don make me to get ticket wey I no expect. Well..., I been kind of expect am. When I been comit de offence I kind of feel say dem catch me. And de mail wey I see for my mail box yesterday don confirm wetin I been tink.

Last two weeks I been travel go Indianapolis to go see my elder bros and him family. And I travel with 6:00pm flight. I book my flight late and de only ticket wey I find na evening flight. I arrange to drive from work to board my flight.

Dat experience don make me realize say ee fit be very bad idea to work de same day wey you need to fly. I close work den begin drive to airport. Tinking say I get enough time, I begin take my sweet time dey drive jejelly to de airport.

Big mistake! I jam go slow, and as time come begin go, I come begin shake small. But I still feel say time dey for me to reach airport on time. Dat one no happen. Like I talk before, I buy my flight ticket late, so de airport wey I dey use before no come get ticket for de day wey I want. So I buy ticket for de next nearest airport.

And na dat same day wey my GPS come play film tricks on me. De address wey I type for my GPS carry me go "lokoja" when my destination suppose be "ogoja". My GPS carry me go where I know say no resemble airport. Town wey I no too sabi, 30 minutes to my flight and I don miss road. Na dis kind situation wey yoruba man go shout EBAMI OO!

Come see my speed racing to de correct address of de airport. De kind driving wey I do dat day eh, ee no get part two. I sure say I run red light like two times. I no even send if police dey for road. My mind na to catch my flight, even if ee mean for de pilot to open door for me to enter afta im go don close am (like say na molue I dey go enter!!).

Tank God I reach on time. I be de last person and na so everybody dey look me one kind eye. Na so I dey breath like person wey run marathon. But dat one no concern me, I make my flight.

Afta all my travel waka to indianapolis and back to my texas, I come get dat mail wey I been talk about. De mail get $75 ticket for "running de red light". Omo, dis people no dey play for hia oo! Inside de mail, dem put photo of my car as ee cross de traffic light.

Well..., ee beta pass police pull ova or accident, because de way wey I been drive dat evening, I really deserve to land inside real hot pepper soup!

No comments:

Post a Comment

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...