PIN MONEY FOR YA DRESS

I remember one day wey I see one of my fellow worker pin money for her dress. I come ask her why she do am, den she tell me say na her baiday. "Ok, na ya baiday, but why you come pin money for ya dress?" Den she come tell me say na money wey people give her for office wey she pin for her dress.


I don notice say for work place, if na ya baiday people go give you money so dat you go pin am for ya dress. Dis one go make any oda pessin wey see am to know say na ya baiday and dem go donate for you too. I don see as some people go pin money until ee go reach dia knee.

De main reason for dis pining money tin na for dos wey no get time to buy gift or card for you to still do sometin to show say dem dey wish you happy baiday. One of my female coworker ask me to donate money for her baiday one time like dat. And for you to donate, you get to pin de money by ya sef.

You need to see me as I dey struggle with de pin and also dey try to make sure say I no "inappropriately" touch her blom-blom. I no lie you, de tin big sha and my eye take style dey look anoda tin as I dey pin my $5 for her dress. For hia sexual harassment na very easy tin for pessin to put for ya head. So most guys wey no get liver go just give de woman de money to pin by her sef. But as most tins for hia get double standard, de women no dey feel any shame when dem dey pin de money for men shirt (aftarall no be wetin we like?).


NIGERIAN NEWS, NIGERIAN NEWSPAPER, OSHIOMHOLE,  OBASANJO, BUHARI, AMAECHI, TINUBU, GEJ, KESHI, SUPER EAGLES, CHELSEA, WIZKID, DAVIDO, LINDA IKEJI, DON JAZZY,
JAY Z, OBAMA, JUSTIN BIEBER, DRAKE, CHRIS BROWN

1 comment:

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...