YANKEE AND NUMBERS

If you don stay for dis yankee for some time, you go sabi say plenty part of dem life connect well well with numbers. Dem go describe most tins like pessin weight or how long ya travel go be or wetin weather be outside with numbers.

For hia, pessin weight na very serious mata, especially for women dem. Na so everybody dey check dem weight, so dat dem fit know weda dem don gain or lose weight. And dem dey measure am for pounds (we ma dey use kilograms). When some women just gain sometin like 5 pounds, ee go be like say world don end for dem. Na so dem go dey try everytin to lose de weight. And de sharp business men don sabi dis one. Na so dem go dey full TV with different advert of how to lose weight.

When you meet babe, especially for online dating website, she go wan know ya height. Some go tell you say dem no go date any pessin wey no reach 5'11' (dat one na 5feet 11inches). Wetin dem wan carry ya specific height do, no clear me at all! For naija, tall na tall, short na short.

Den for sports, everytin na about STATS (na short form for statistics). If any skool wan give any student sports scholarship, wetin dem go first check na de student stats when im been dey sekondari skool. For example, if dem wan recruit any player, dem go check de average of how many 3points wey im make, how many assists, how many rebound, and how many 2points. So na im make every skool must get correct record of wetin each player make for any game wey im play. To keep record for yankee no be child's play at all. Dem dey take am very serious.

What of with moto? Number dey very important. If you wan buy second hand moto, de first tin you go check na how many miles wey dat car don waka. If ee too much den ee go affect de price of de moto. If you wan buy moto, you go check how many miles wey de moto fit reach with only one gallon (dis na equal to 4 liters). De more miles wey de moto fit drive with just one gallon, de more costly de car fit be. Or if you wan change oil for ya moto, de mechanic go tell you how many miles you suppose drive before you change ya oil again.

As you dey travel for any road hia, na so you go dey see signs wey go dey tell you how many miles you don drive or how many miles remain for you to reach where you wan go. Dis signs dey very easy to understand and you fit no need any GPS or map to find where you dey go sometimes.

Abi na weather mata? Every tin na about numbers. Every news channel get section wey dem must talk about de weather for dat day or de whole week. Some go even break am down to every hour. No be hot or cold, but de exact temperature (dem dey measure dem temperature for Fahrenheit). Yankee na place where natural disaster fit happen anytime for any place and so everybody dey take de weather for dem area very serious.

Yankee dey very organize sotey every pessin get dem own "tally number". Dem dey call am social security number. Once dem born you, govment go give you ya number. You need am to find work, you need am to fill any govment form, to go skool, to get scholarship..., any kind tin wey you need to do wey concern govment, you go need dat number. And so afta ya phone number, ya social security number na de second one wey you must remember.

And anoda tin wey surprise me na de way everybody dey used to numbers. Even people wey you know say dem no go skool, dey use numbers to describe everytin. And if you come from anoda country, you no get any choice but to learn how to use am. Simple tin like when you dey give direction, you must know how far ee be for miles or how many blocks to where you need to go.

May be na im make dem don develop like dem be. No be like us wey still dey describe most tins with hot or cold, tall or short, far or near, small or big. Hia dem dey use numbers and I believe say na beta way to describe tins.


NIGERIAN NEWS, NIGERIAN NEWSPAPER, OSHIOMHOLE,  OBASANJO, BUHARI, AMAECHI, TINUBU, GEJ, KESHI, SUPER EAGLES, CHELSEA, LARA FORTES, WIZKID, DAVIDO, LINDA IKEJI, DON JAZZY,
JAY Z, OBAMA, JUSTIN BIEBER, DRAKE, CHRIS BROWN


No comments:

Post a Comment

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...