MAKE WE HAIL DE ALMIGHTY C.P.S!!!

If you get pikin for dis country, de number one pipo wey you suppose fia well well na CPS. CPS full name na Child Protective Services. Dis na de guys wey go come collect ya pikin for ya hand if dem feel say you no dey take proper care of dem as govment want. I say eh..., dos pipo don rearrange plenty families like as pessin dey shuffle whot. Once dem land ya house, dem no get time to yan with you, dem go use police carry ya pikin comot. And if dem feel say ya case serious, dem go arrest you join.

I don see pipo especially single mama dem wey don lose dem pikin for some kind simple tins like dem pikin dey play den come get wound. CPS go say na "child endangerment". Parents dey fia to correct dem pikin because dem no wan enter any wahala with dos pipo. If you flog ya pikin, give am mark and ya pikin teacher see am for skool, you don buy mrket be dat. And most children understand dis one and dem dey use am threaten dem papa and mama. If you wan correct ya pikin, den dem go remind you of CPS.

Even pipo wey you know fit set you up. If you and ya neighbor or ya relation dey quarrel, dem fit call CPS and tell dem one big lie wey go make dem come take ya pikin. And depending on how serious de case be, ee fit be bye bye forever for you and ya pikin. You no get any legal right to ya pikin again. Imagine how you go feel if dat one happen to you.

Plenty children don end up for govment hand, and we know say anytin wey govment dey manage no dey turn out well. And even if dem give de pikin to foster parents, no be gurantee say dem go treat de pikin well. Ee get plenty cases wey dis children don suffer abuse for dem new family hand wey worse pass wetin dem suffer for dem original papa or mama hand.

But no be everytin about CPS wey dey bad. Dem don save plenty children life from some serious kolomental parents. Some kind tins wey some parents fit do to dem children for hia just no get part two. Child abuse hia na everyday tin. Pipo wey no get any business to born pikin, just dey push dem out like popcorn machine. CPS don helep some children to go live with dem grandmama or auntie wey fit take care of dem well. And dis one dey usually happen when dem mama dey enjoy her sef with hard drugs. If no be for CPS, na only God for fit save some pikin dem.

Like say CPS dey naija, and with de kind flogging wey popsi and momsi give us when we small, CPS for don arrest dem like 1 million times.., lol. Especially my popsi, de man no dey hia word when ee come to koboko tins. Me and my senior broda been dey call am "commando".., lol. If any of us wan do any stupid tin, na so de oda peesin go shout, "shey you wan commando to deal with you abi?" Momsi no get time to flog, na to twist ya ear den come land you one solid slap for ya back.

No be like say all de papa and mama for naija dey do dem work as parents well. I remember some kind tins wey some kind parents dey do to dem pikin. But since we no get anytin like CPS nothing anbody fit do about am. if you talk anytin, dem go tell you to "mind ya own business". Maybe we need something like CPS for naija..., or maybe we no need am!

Me personally see dis CPS tin like knife wey sharp for both sides. Ee get im good side and plenty bad side!!



1 comment:

  1. If there were CPS in Nigeria, even the CPS will bring koboko and flog the nonsense out of your head if you disrespect your parents, cos culture is very strong here.

    As for those kids who use CPS to threaten their parents, if any child tries that with me, he is OYO o. Let him go and live with foster parents na, and let's see if his life will turn out better that it was when he was with me.

    Atilola's World

    ReplyDelete

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...