BASEMENT

Ee neva too tey wey tornado visit two small towns for Illinois state- Rochelle and Fairdale. No be small tin oo! De tin level the place. All de houses for de two towns disappear, and na so property scatter everywhere. For hia, dem dey like build house with wood and plastic sheets, and when any of de big breeze come, na so ee go knack dia house fall like paper.


But de good tin be say na only one pessin die and some wey get wound for dis tornado. Normally dis kind tornado dey kill plenty people. De tin wey dey save some na say dem house get hole for ground wey dem dey call basement. Once dat strong wind don begin come, na so all man go rush go under ground to go hide. If you no get basement ,you go enter ya bathtub and cover ya sef well well.

Apart from say basement na where people dey go hide when tornado come, ee get oda tins wey dem dey use am do. Na for basement wey most family dey pack dem extra property. All dos tins wey you no get space to put for de main house, you go carry dem dump for basement.

Odas dey use am as guest space when you get visitors and you just wan go relax with dem, play games or drink and make noise so dat ya neighbors no go hia den go call police. Or if ya pikin dem dey disturb you and you just wan go where you no wan dem wahala, you go go ya basement go chill.


Some people basement dey be like second palor or game room or bedroom, depending on how you wan decorate am. If you get too many visitors wey go sleep for ya house, you fit turn ya basement to bedroom. If you like to play music instrument, ya basement go be de best place to go practice.

Also na basement wey de family dey dash any lazy family member wey no wan helep im sef. If dem no wan see ya face and dem no wan troway you for outside, dem go give you de basement to live. For hia na big insult if somebody tell you say you still dey live for ya papa and mama basement. Some dey even prefer to dey homeless dan for dem to live for basement.


Once you reach 18 years for hia, ya papa and mama go give you quit notice or you follow begin contribute for rent (dat is if na rent dem rent de house). But if you no fit pay and you no get anywhere to go, den na underground you go begin live. How you wan tell anybody say na basement you dey live? Dat one na hand falling be dat. But some no send, I don hia of people wey don live for basement for years. Well..., if papa and mama no disturb dem, den ee no worry dem at all.

2 comments:

  1. I like the way houses there are built with wood. It's not like the expensive cost of building houses in Nigeria - using over 10 million naira.

    Atilola's World

    ReplyDelete
  2. The first day I hear tornado alert, nah so fear catch me o. We no get basement for apartment. Nah only 2 bath tubs dey, so where we go run to? GOD help us o.

    True. True. The houses nah pako and Dunlop. That is why small noise go shake the whole house. But I expect say houses prone to this kian natural disaster more, will use brick instead of pako. All the same, dem don know how to do their thing.

    Basement get e own palava o. Some dey hide people there for years. That is why I dey fear am small. Send pickin comot for house immediately he reach 18, unless he contribute financially? That is after them finish high school be DAT ke! I no fit o.

    ReplyDelete

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...