PRENUP

"For better or for worse, till death do us part.....,". No oo...., pastor you go slow down with dat ya talk oo! For yankee na for beta for best! Nobody get time for worse oo! If ya money finish, na bye bye until forever! So na im make most men wey don make plenty money no wan take chances with dis gold diggers wey dey everywhere. Dem go make you sign paper wey go stop you to collect half of dem property.


You see for hia,divorce na normal tin oo! You wake up and no like to see ya wife or husband face, you go just divorce am. People no get patience at all when ee come to settle marriage mata. Some go even make excuse just to make sure say dem end de marriage.

And na de women dey always run go court first to end de marriage. De man go lose half of everytin wey him don make. Na im make most of de sports guys or actors or big business men dey make sure dem wife sign PRENUP before dem marry. Dis one go make sure say if and when de marriage end, she go only get how much wey dem write for de prenup.

But most guys don hia am for some women hand, because say dem no been get prenup agreement. Dem marry because of dat tin wey dem call LOVE. Dat one no dey work for hia at all oo! Especially when you get plenty money. For hia de women eye dey chook well well for money. You dey talk of gold diggers, yankee na de headquarters for dem! And de system dey make am easy for women to suck life comot for de men for hia.

So na im make most men just wan born pikin but no wan go through de marriage and divorce wahala for hia. Dem no get time for love. Some go tell de women, born for me and collect ya monthly child support check. And most women wey tink say dem no get any choice, go just gree for dat kind arrangement. Family structure for hia don kaput since time imo river. Yankee don get generation upon generation wey don grow up for house wey no get papa and mama for de same roof.

Women dey complain why dem men no dey wan commit to serious relationship, but dem forget to realize say na some of dia fellow women wey don make de men learn bitter lesson about divorce. Afta you see as fellow men dey lose everytin wey dem don suffer get, why you go wan put ya sef for dat same wahala.

Just imagine for naija, you tell naija man say him must share everytin wey him get 50-50 with him wife afta dem divorce. Dat one no go ever happen. Except say na business wey him and him wife start togeda, den dem fit share am. Naija women dey always carry last for divorce case. And I sure say na im make divorce no day too dey common.

6 comments:

  1. Even if dem start the business together, 9ja man no go still share am half! By the time his family join hand fight the wife, she go kukuma leave the man for peace of mind. I be write about divorce mata for here sef .http://www.thenitty-gritty.com/2015/03/i-want-divorce.html

    Relationship mata for yankee full for mouth to talk...where pesin want to start from sef...love ko, love ni!

    ReplyDelete
    Replies
    1. De tin tire me too. But dis one wey people dey enter marriage and dem don dey plan dia divorce just tire me well well.

      Delete
  2. Marriage ova dere is crazy..how will you marry just because you want to gain half of someone's riches...nawa for some people..jay stan abeg stop puttn blame on rhem women..na wetin they don suffer for man hand dey make dem behave like that..

    www.glowyshoe.blogspot.com

    ReplyDelete
    Replies
    1. This comment has been removed by the author.

      Delete
  3. Very informative blog. Nice information and data. Every need bt help this days. For instant bt help see bt password recover

    ReplyDelete

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...