BOKO MARAM abi na BOKO MAGA

Na with serious vex for my mind wey I dey take write dis post. I don tire for dis people and dem madness. Everyday when I check Naija news online, na dem smelling stupid gist I go dey see. De tin don too much. Which time wey dem go stop dis kill kill.

You turn TV to hia news, na one of dos tory about Naija wey you just no wan hia go dey for news. Na wa for dis people. Ee don too much. God oo, we need ya helep for dis one. We govment no sabi wetin to do (dat one no surprise me at all).

And de one wey dey pain me pass, na de one wey dem dey use small small girls as suicide bombers. So human being go bring small pikin, tie bomb for her body, den carry her go drop for where people plenty and blow her up and everybody around her. And some how dem believe say dem dey do de work of dem god?

I don tink this tin tire and I get too many quesions wey I never fit find de answer to. Where dis people dey get dem supply of guns? How come dem fit get steady supply of weapons and Naija govment dey find am hard to get dem own supply? How come all dis foreign media people fit get access to de latest videos and news about dis people but Naija govement no fit locate where dem base dey?

With all dis dem female sucide bombing, how many of de chibok girls still remain? Imagine de kind pain wey de papa and mama of dis girls dey go tru everyday. Even me wey dey yankee dey always tink of de safety of my people for Naija.

Na pray I dey do everyday for God to protect my family oo! Dis tin no dey funny at all. Who believe say Naija go be place where bomb go dey explode everyday like knockout for January 1st. Baba God na you we dey look up to. And I pray say dis february 14th election, God go give us de leader wey go helep stop dis crase people.

AMEN OO!

No comments:

Post a Comment

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...