MARY JANE


Maybe you neva hear about dis type of babe before, but she be very contoversial chick for yankee oo! Dos wey don friend her type say she go make you feel good. She go make you calm down. Oda times, she go make you laff well well and forget ya wahala for some time.

Depending for de State wey you meet her, ee fit dey legal to friend her OR very illegal to even dey around her. De number of people wey don go jail because of her plenty no be small. From old people to youngie dem and even teenagers, everybody don hia am for Mary Jane hand.

But with all de wahala wey she dey cause, people still dey friend her. De more some States dey increase de punishment, na de more people dey follow her for yansh like fly. De tin don just dey out of control for dis yankee.

And most times, her pimps (dos wey dey arrange customers/dates for her) no wan stop at all. De more police dey pursue dem, na de more dem dey invent new tricks to avoid dem. I say ehn..., de chick and her problem no be small.

Me I neva date dis type babe before, yes na true I dey talk. Her wahala just too much for me. I no get de strength for her shakara. My guys don tempt me tire to try her, but I no get enough liver to try am. With some of de bad tory I don hia about Mary Jane, I no fit do am.

Recently some States don make am legal to hangout with MJ. But some no wan gree at all. Dem go give you all de excuse wey dem get, like say she dey make her friends to commit crime or say she dey cause serious sickness to her padi dem. But dos wey like her well well dey try to make sure say ee dey legal for all de States to befriend her.

Most big men don confess say dem don be with her before. Most actors, musicians and even politicians don be with her. Even Barack Obama don talk say when him been young man, him and Mary Jane been dey run tins. De babe don try well well oo, lol. She be really cheerful giver.

If you still dey wonder who dis babe be, make you know say she dey everywhere. Ask around and you go find her. I no say make you friend her oo! Just ask people around you, she no hard to find.

No comments:

Post a Comment

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...