TREE HOUSE

Some people dey find place to build house sotey dem come decide to build am for on top of tree. Yes oo..., tree as in leaves and branches. I see dis tin for one reality TV show where dem specialize for how to build tree house.

Na very interesting show. Dem go start from scratch. First, dem go decide de tree wey dem go wan use. Sometimes dem go choose two or three strong trees wey dey near each other. And most time na long pine trees or de type of tree wey de branch dey very very high.

Den dem go draw plan just like regular house plan. With palour, kitchen, toilet and bathroom and bedroom. I dey tell you, when dem build dis tin finish, na so ya eye go open as dem begin show you inside de house. Dis guys go connect electric and wata go up dat tree house.

Ee get some wey get upstairs. I don see three or four storey tree house. Oyibo and dem way dey tire me sometimes, lol. To build house for ground no dey cool again, now na for on top tree be de in tin to do. And dis house no be like say ee dey shake or anytin. I don enter one of dem. If you dey inside, you go tink say na regular house wey you dey inside. No shaky shaky for de floor. Dem make dis tin strong kakaraka. De tin get solid support for all de sides of de house.

But I come dey tink, like say you dey inside and one of de trees come break. Wetin dem go call dat one? Treequake! Or if squirrel or woodpecker come begin make hole wey you no notice until ee come dey very deep. And de whole house come tumble. Dat one go dey very interesting.

De house na mostly wood with some rods and small concrete. So ee dey necessary for de owner to dey regularly change bad wood. Tree house na for people wey get too much money. Me I still dey find money to build house for ground. Maybe until dat one don happen, I go build tree house or even sef I go wan build house for air. My house go dey float and carry me go anywhere wey I wan go. At least I no get to buy land or pay land tax.

No comments:

Post a Comment

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...