NAIJA MUSIC

As I dey cruise my moto yesterday and dey listen to SIRUS XM, I come hia music wey surprise me well well. I like to listen to reggae music for satellite radio. Na my favorite type of music. De guitar and de melody of reggae songs dey touch me for body anytime I listen to am.

So yesterday as usual, I tune to sirus xm reggae station, and den afta 3 songs don play, I come begin hia, just like de sun lights up de earth, you light up my life........ Wetin I dey hia so? Na tuface African Queen dey play. Honestly, de tin shock me I no go lie. Tubaba don really go international.

Naija artiste don dey make name for dem sef for some time now. And dis one no be small achievement. Boys and girls are not playing oo! Dem don colonize de whole Africa and even begin go Europe and America. Dem don dey win BET award and sign major recording deals.

We don see as Asa, Nnenna, Cohbams and co., just dey shine like a million stars everywhere, as dem dey rep Naija well well. Nothing dey give me good feeling pass when I see my people dey do dia tin around de world and people dey appreciate dem. I remember as Psquare song- Personally spread everywhere. And Dbanj own- Oliver Twist  been get massive air play for Europe.

Dos early times when pessin come yankee, na Naija music wey I dey take console my sef anytime I feel home sick. I dey spend hours for youtube dey jam awa music. If anybody ask me about de music, na so I go dey give dem lecture about de artist. Naija music really sustain me during dos hard times when I go dey tink weda na good idea say I leave Naija to come yankee.

Make I use dis post to tank all dem musicians wey dey spend time produce good quality Naija music for all of us to enjoy. Una dey really try well well. If you go any Naija occasion, na strictly Naija songs DJ dey play. And na so you go see as onyibo and akata people dey gbedu to awa songs like no man business. De tin dey give pessin small pride say good tins fit comot from we country.

But ee get anoda tin(s) wey I go wan point out about we Naija musicians wey I feel say no too dey good. De first one na dis new idea to dey use dat stupid word- NIGGA for songs. Wetin dis one come mean? Dis one na word wey dey cause serious wahala for hia. And to see my guys dey import am to Naija through music just dey make me wonda.

Anoda one na dis new trend wey musicians don dey born pikin outside marriage. De tin don become serious trend among dis guys. Who be de papa and mama of de girls wey dey allow dem pikin to carry belle for dis guys. And na which kind example dis guys dey set for dia young fans?

And dis one wey all dem videos just dey show girls as dem dey ASHEWOrize dem sef. Ee bad enough say una dey spray money and show off expensive tins like say na wetin life be about, now na to begin turn we sistas to BITCHES and HOES be una new plan?

Na true say sex dey sell music, but good music go always sell pass, ask Fela, Tuface, Bob Marley and Michael Jackson. Music wey good, people go buy am, and you no need to try sell ya music with sexual images. I still dey listen to Naija music, but with de way dem don begin sound de same and to dey only sing about money and sex and alcohol, I don begin select wetin I dey listen to.

Maybe I dey different, but rubbish music dey give me headache, no mata how catchy de beats sound!!

No comments:

Post a Comment

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...