HOME SKOOL

You know say pessin fit dey house finish all im education from kindergarten to SS3? Yes dis one surprise me when I find out say ee dey possible. And ee dey popular for here.

To make ya pikin to go skool from house, you need to obey some laws wey de govement for ya state go give you. And you get to buy de textbooks and oda skool tins wey regular skool students need. You need to dey supervise ya pikin and to make sure say dem dey do all dem skool work. Dem get to write test and exams to show say dem dey do dem skool work.

Most of de parents wey dey do dis one na dos wey feel say regular skools no dey teach dem pikin well, or dem feel say de skool no dey safe for dem pikin, or dem feel say de skool dey spoil dem pikin. Some parents wey dey travel well well dey prefer to teach dem pikin for house.

Some research don find out say pikin wey go skool for house dey sabi book pass some wey go regular skool. Dis one fit be because of say de papa and mama make sure say de pikin do dem skool work.



But sometimes too, dem don find out say dis kind pikin dem no dey sabi most tins wey dem suppose know for de class wey dem dey. And dis one na sake of say most parents fit no send at all or no get time to teach dem pikin bukuru work.

And some people dey argue say home skool pikin no sabi relate with people (poor social skills). Say since dem no dey mix with oda children, dem dey find am hard to mix with people. Well dat one fit no be true, aftarall de pikin get oda times wey im fit mix with children like am(for church or with de neighbor pikin dem).

With de kind tins wey dey happen for skool nowadays, from shooting to drugs to bullying and oda bad bad tins, you go begin realize say HOME SKOOL fit be de best alternative. Atleast you know where ya pikin dey and wetin im dey do. You go know weda ya pikin dey do im skool work or im dey lazy.

But honestly..., how many parents fit really do home skool for dem pikin. Dis one wey almost everybody (both papa and mama) must go work. Dat one take style hard well well. Most people wey dey do home skool must get atleast one parent wey go dey house fulltime (most times na de mama) or de parent dey work from house.

Dos parents wey dey do am go tell you say de tin no dey easy at all. If you wan make ya pikin get proper education, you must put ya eye down and find time to monitor dem progress. And all of dis parents go always tell you say dem no regret to do am.

But make we no forget say dis tin wey we now know as SKOOL really start  from house. For olden says, everytin pikin suppose learn dey happen for house. Even de first regular skools start from somebody house. People go bring dia children to "teacher" house. And den when population come begin increase, dem come decide to build separate place wey people need to go learn.

I wonda if we fit start home skool for Naija. I believe na sometin wey go dey good to do.



**************************
happy new year
**************************

No comments:

Post a Comment

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...