GROCERY SHOPPING

Now to my fellow guys wey dey Naija, make I ask una sometin. You remember de last time wey you and ya wife or ya significant oda go market to buy tins. You still remember as she make you carry all de tins wey una buy? You just de follow her for yansh and dey frown ya face like pessin wey lick lime. But you no fit talk anytin because say you no wan hear her mouth.

Hmmmm......, Naija guy go gree follow him woman go market to go hold shopping bag for her? Unto which levels wey dat one go happen? Naija men and dia ego wey big pass dem head, go gree follow dem wife go market or go helep her buy house tins? "A whole Him"!

I remember all dos saturdays wey my mumsi go force my papa to go drop her for market. I remember how ee go take my father like forever to gree to go drop her. And den my popsi go make sure say one of us (de children) go join dem go market. Afta him drop us, him go kuku go sidon for one joint and den wait for us to finish shopping. Den as guy man, him go come bribe us with pepper soup and malt before we go back house.

And den when we come grow to begin drive, my father come take style retire small from de saturday trip to market. To follow my mother go market na serious punishment be dat. She go carry you waka de whole market like two times. Before she go buy anytin, she go price dat tin from like four people before she buy am!

Ee get some saturdays wey everybody go sneak out from house go hide somewhere. Dis na because when she ready to go market, de first person wey she see, na dat person go follow her go market. I come notice say na afta we don eat morning food and come rest small, na dat time she go begin talk about to go market. So my game plan na to rush my food quick quick, den disappear from house before she go begin talk about any market waka, lol.

But here for yankee, ee dey different. For here, men and women dey go shopping. Some women dey even send husband or boyfriend to go market to buy food tins (dem dey call am grocery shopping). No argument, no complain. I don dey supermarket, dey see men dey push shopping basket, as dem madam dey waka for front. Come see as de women dey control de men with dia finger. "Stop here. Turn dis side. Turn around enter here!". Well..., de men go just do as dem madam command dem.

Na some of de tins wey dey make some Naija men for yankee still wan marry Naija woman, lol. Awa sistas, at least most of dem still dey massage dia men ego. Dem still dey go market alone to buy food stuff, come back house and still cook for dem family. Tank God for Naija women. At least pessin like me go still fit......!

No get me wrong oo! Nothing dey wrong for man to follow him woman go market and helep her do her shopping. Ee go make you appreciate ya woman and all de suffer wey she dey go through to manage una house. Times don change well well, and so we men suppose begin change awa mind set too. Stress for here to much, and ee no go dey good for only one pessin dey do all de house work.

My fellow men, you wey dey yankee, make out time go buy food tins sometimes from Walmart or Brookshire's. And if you dey Naija, make you try go dat Mile 1 market sometimes. Dis one no go fall ya hand, infact ee go make ya woman like you well well. And trust me, she go reward you PERSONALLY and PSYCOLOGICALLY!!!

No comments:

Post a Comment

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...