404 IS NOT READY FOR HIA OO!

Omo no be small tin oo! Icause some kind controversy with some people wey I been dey gist with. We been dey talk about food, and so we come begin talk about some of de kind meat wey we like. Pig meat na number one meat for yankee, and den beef and chicken. Well beef and chicken one na normal meat for every place for de world wey you go.

Den tory come enter de WEIRD meat wey dem don chop. De list long no be small, aligator, raccon, hogs (bush pig), duck faul, bush rat, horse, squirrel. Okay now..., I tink say tory don end dia, na im dem come ask me de kind meat wey we dey chop for Naija.

As I begin call names like goat meat, I come discover say some of dem no even know wetin goat be! I come add say some people dey chop cat and dog meat.... Lol, ee just dey like say I tell dem say some people dey chop small pikin for Naija. You need to see dem face. I come begin talk for my mind "no be una ask me to tell una meat wey we dey chop!"

Yankee people no dey joke with dem dog at all oo, lai lai! I know say for some of dem mind dem go de say "no wonda we dey call dis people bush people". Well wetin concern me? Me, I neva chop 404 before and I no intend to chop am anytime soon. And de few times wey I find my sef around Calabar and Akwa Ibom area, I really make sure say I know de kind meat wey dem serve me. Na only goat meat and chicken I chop when I been travel go dat area. At least I know wetin goat and chicken look like and taste like.

So if you dey come yankee and you like 404, my advice to you na to chop as plenty as you fit chop for Naija or make you package am come as dry meat. Beacause for hia you no go find am and make you no even dream of to arrange any dog for hia oo! Dat one na jail mata be dat!!

No comments:

Post a Comment

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...