AZUKA OGUJIUBA vs DBANJ

I been jam dis aricle online wey dis babe Azuka write about de koko master- Dbanj. De tin take style long and carry plenty yabis against my guy. Ee dey like say de babe and Dbanj be paddy before or dem still be friends? De main tory for de article na say ee be like say Dbanj star don begin fall.

She talk as dem first meet and how she helep him and Don Jazzy become popular. And how Dbanj come begin form levels for dos people wey helep am for him career. Well all dis one no be wetin catch my attention for de write up. Wetin I find very interesting na when she begin talk about de guy 10 year anniversary celebration.

According to her, de whole show na complete disappointment. De yankee chick wey him bring no try at all. Amber Rose come begin form on stage like say she dey ova important. Azuka begin talk about how Dbanj dey act like say yankee people dey superior to him fellow Naija people. And how him abandon him career for Naija to go follow Kanye West. And how Kanye West treat am like houseboy afta him sign am to Good Music!!

Now make I yan about de main reason I decide to write dis post. First of all, ee really surprise me how guy wey don live for UK for some time and don experience first hand how westerners dey feel about us go still dey act like small pikin around dem.

No get me wrong, you fit do business with anybody from any part of de world. But when you begin act like say to be around yankee person be de best tin wey don happen to you, den dat one no good at all. Dbanj been dey busy dey snap picture with every americana wey him see and dey post am online. Like say dat one go impress anybody.

Guy wey don get so many fans sotey him come be de biggest star for Africa and oda places, come decide to leave all dat achievement behind to pursue obodo yankee life with Kanye West take style shock me. De guy already na mega star by any standard. But I guess dat one no belle full am or him no been really know how big wey him be.

Don Jazzy wey get more sense decide to no join am for him yankee waka. And now ee dey clear say afta dem two break up Dbanj be de loser for separation. Maybe dis one go be lesson for all oda Naija stars. No tink say you go come hia come out shine dos wey already dey hia.

De example of how yankee people dey treat awa stars plenty no be small. See as dem dey yeye awa musicians for BET awards every year. Any article you find online dey usually get indirect insult against awa celebrities. Dia comedians dey always yab us like say we be inferior human beings.

 No be small tin for hia oo! Na endure wey we dey do hia everyday. Lol.., you go just develop thick skin and absorb all de insults wey go hit you everyday.

Anyway sha, I hope say any Naija person wey still dey see yankee people like god need to know say dem no tooooooo... send ya type. I wonda why Dbanj no understand dis one!!


No comments:

Post a Comment

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...