'LOVE' TATTOOS

I no like tattoo since time imo river. I no fit see my sef enter tattoo palor, den com sidon make anoda pessin use pin dey chook my body with dat dem electric pin. And den come begin inject my body with dem ink. My body na no go area for tattoo.

But when I look around, na so almost every pessin get tattoo for body. People dey get am for every part of dem body. Just tink of any part, somebody get tattoo for dat area. And tattoo business her dey very big. Na none stop customers wey dem dey get.


And when you check de entertainment industry for hia, na so every artist get ink for dem hand, dem back, dem neck e.t.c. Ee just dey like say dem pour dis guys with bucket of ink. And den when you see dis awa naija musicians, you go see as almost all of dem don begin tattoo all dem body. Na wa oo!

Anyway, wetin I no too understand about dis tattoo tin, na how people dey write sometin about dos wey dem say dem love. Like you go see ass somebody go tattoo dem mama or papa or any loved one name or face for dem body.

When you ask dem 'why?', dem go tell you say na how dem wan take show dem love. Or dem go say na so dem wan take remember de pessin, if de pessin don kpai. Well I no wan judge anybody about wetin dem dey do with dem body, but wetin I dey tink be say, if na so you wan take show love or remembrance to dos wey you love, na im be say ya body go cover with people face.

What about dos wey dey write language wey dem no understand for dem body, like Chinese? I hia one tory where pessin tattoo im body with Chinese language, and she been tink say ee mean "I'm all yours" for her back waist area, but lata come find out say de tin mean "I'm a bitch"... lol.

No be small tin oo! Me ma.., I don answer quesion tire why I no get any tattoo for my body, and I dey always tell dem say I no need to show love or remember anybody with ink for any part of my body. My mind na where I need to keep dos wey I love, and my actions be how I need to show say I love people.

I no need any tattoo for my body and I no get time to begin explain wetin any tattoo for my body mean.

No comments:

Post a Comment

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...