AKATA COMEDIANS

One of de ways wey I dey take pass time when I no get anytin to do, na to go for youtube to watch jokes from stand up comedy. Sometimes, I go spend hours just dey watch stand up comedy. I go watch white, akata, latino and even naija stand up comedian.

But I dey usually enjoy akata stand up comedy. De style of dis comedians just dey different. Dem no get filter for dem mouth when ee come to POLITICALLY CORRECT topics. Dem go talk about any and every tin. Dem no send at all.

And when ee come to dat word- NIGGA, dem dey use am like chewing stick. Dem don make dat word popular for everywhere. No mata how news people try to criticize akata comedians as dem dey use dat song, dem no wan slow down at all.

Den anoda tin wey I notice, na how dem dey always attack Africa and people wey come from Africa. No be small tin oo! Some kind tins wey you go hia from dem mouth go just make ya body shiver. And de audience dey enjoy de jokes well well.

But as pessin wey come from Africa you go see de ignorance for some of de tins when dem go talk about Africa. And den when you meet some people, you go see say dem dey get most of dia ideas about Africa from wetin some of dis comedians dey talk for dem show.

But wetin pessin fit do? Well..., you go just shake head and behave like say de tins wey you dey hia no dey bother you at all. You no wan begin argue with anybody, because dis one fit cause serious quarrel. Trust me, I don see dis one happen before!!

2 comments:

  1. I go try watch some to see, their mannerism and slangs is difficult for me to understand sometimes, so it takes me a while to catch a joke when I see am for movie, unlike our own people, if dem cough sef, I go understand the joke and laugh. Dem get freedom of speech pass 9ja nau, so dem fit yarn anything and liver no go fail dem, unlike my people, where touts fit go beat them for yabbing dem sef! :D

    ReplyDelete
    Replies
    1. my dear na de same tin I dey do hia oo! akata get serious issues against us oo! na sometin wey I been no get any idea about until I begin interact with dem. and now I just dey maintain my own lane.

      Delete

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...