AKATA WOMEN BEEN DEY BREASTFEED OYIBO PIKIN DEM

If you don watch dat film wey im name na THE HELP, you go see as life been dey for yankee around 1950s. Dat time, na mostly akata women dey do house helep work for onyibo women. And dat time, na de most popular work wey akata women fit get.

But dis tin no really start today. Even for way back, na akata women been dey take care of onyibo pikin dem. Wetin dat one mean na say onyibo pikin dey spend more time with akata house helep pass dem own mama.


And I believe say dat one dey make akata women to no get too much time to spend with dem own pikin dem. But I fit dey wrong about dis one, na just sometin wey I dey tink.
Den when I begin research dis history about yankee, I come discover sometin wey really shock me!! De tin wey I been find out na say during dos olden days, akata women been dey breastfeed oyibo pikn wey dem been dey take care of. If you dey doubt me, make you check internet and you go still see for ya sef.

Na wa oo! Dis country history take style dey ova complicated. And dis na time wey dem been dey treat akata people really bad, but dem still allow de akata women to breast feed dem pikin. No be small tin oo! And my quesion come be say, where de onyibo women been dey or wetin dem been dey do when anoda woman dey breast feed dem own pikin?

Imagine say naija woman allow her house helep to breastfeed her own pikin! I no even wan imagine dat one. Just imagine how a typical naija woman go react when she enter room den come see as her house helep breast dey inside her baby mouth. Ya guess dey as good as my own!!

Any way sha.., dem say culture dey different different. So me I believe say dem get dia reason why dat one been happen during dat time sha!

No comments:

Post a Comment

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...