BACKGROUND CHECK

For dis place eh, dem go check you up and down, even sef ee remain dem to check ya pant to see weda you get anytin wey you dey hide. I dey talk dis one as ee take concern de tin wey dem dey call background check. Afta you don apply for work, or even as you dey fill de application form, you go see space wey dem go ask you if you do commit any crime before.


If you like make you lie, dat one concern you. Afta you don submit ya application form, dem go run background check with police to find out weda wetin you talk for ya form na true or na lie. And make God helep you say you no talk true.

Plenty people wey qualify for some kind work no dey get am sake of say dem get some kurukere for dem record. Even afta you don pay for ya offense, de tin go still dey for ya record. And de one wey dey hold people back pass na de one wey dem dey call felony. Dat one na red flag for any application wey you fill out.

Most places no go even give you chance to explain ya sef. Once dem see felony for ya record, na capital NO be dat. Plenty plenty people no fit get beta work sake of say dem get felony for dem record. And as bad as dis one be, na akata people dey suffer am pass when dem get felony for dem record.

And dis one come make me dey wonda about how we dey take apply for work for naija.., lol. Who get time to check weda pessin get any bad tin for im record? Where you wan go check to find out any pessin past records?

Awa naija police wey still dey use pen and paper to collect people statements? Where dem get database wey you fit check online to find record of any pessin? Abeg I no wan begin talk about awa police wahala hia. We still get plenty tins to do before we begin do background checks for we country.

I just hope say one day say we go reach dia!

Make I apologize to my readers wey dey wonda where I go hide all dis while. Na laziness ova take my brain.., lol. Anyway, I don come back, so make una stay tune for more gist from me!!

2 comments:

  1. Lol.... Na so oyinbo pple dey do!! Very disciplined.......buh why you con dey lazy nah?? See me dey talk I never put any update for my blog since!!!

    ReplyDelete
  2. Lol.... Na so oyinbo pple dey do!! Very disciplined.......buh why you con dey lazy nah?? See me dey talk I never put any update for my blog since!!!

    ReplyDelete

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...