WE FOR YANKEE SUPPOSE TANK GOD FOR SOME KIND TINS WEY WE DEY ENJOY FOR HIA

To begin talk say yankee no get light problem go be very old tory. Yes we know say when ee come to steady light, we naija no fit compare to yankee people. But I dey hia say light don dey dey steady small small since oga Buhari take ova.

Abi na oda tins like say nobody still dey wash cloth for hand, or say wata dey reach everybody house, or say coal tar reach ya very domot e.t.c. Ee get oda plenty plenty tins wey dey for dis yankee wey dey make life to dey very easy for pessin.

No wonda say afta we wey be foreigners complain of how dem dey treat us bad (racism) and how we dey miss we country, still nobody wan go back to where im come from. Deep down you know for ya mind say tins for hia still beta pass where you come from.

Just like dis internet tin, de difference beween internet servce for hia and naija dey like where you dey compare night and day. Dis one remind me one time when I been dey chat with one of my friends for online wey dey naija. As wey dey chat reach like thirty mintes, im come remind me say he go soon log out. Say im time wey im buy for cyber cafe go soon finish.

See me wey dey my house and dey chat with am for wireless internet wey I install for my house. Ee no even occur to me say people still dey go cyber cafe. No be say I dey feel like I get levels pass am, but I don too dey used to easy and fast internet access, and I just come forget say no be so de tin dey for every country, including my naija!

Even when I dey check some celeb bloggers site and ee get video wey dem go ask you to watch, I go see comments like,"me I no get gigabites to waste for dis ya video". Dis na because say dos wey dey use de internet wey guys like Glo nd MTN dey provide, dey try save dem money. I dey hia say dis telecoms companies dey cut people head with de kind money dem dey charge people for internet service. Chai!

For yankee, you fit dey ya house and spend all ya time online dey do anytin wey you like. Like dis blogging wey I dey do, I no tink say I for get de money or de time to do dis one for naija. Dos wey dey do professonal blogging for naija na dos people wey dey actually make money from am. At least dem get money to pay for internet service. For hia I fit blog becaue internet dey very cheap fast and reliable, and I fit afford am.

For hia, people dey do online skool. From sekondari skool work to even PhD degree, you fit do am online. I just dey wonda weda dis kind tin fit dey possible for naija. Now wey be say any kind information wey pessin dey find dey for online, I wonda weda naija fit meet up with de kind speed wey information dey fly like de speed of light for cyber space.

Na wa oo! To say naija still get long way to go na proper UNDERSTATEMENT. I just hope say dos guys wey dey for power for naija go take style stop all dis dem stupid quarel quarel wey pessin dey see online every day, and begin do tins wey go really helep de citizens like to provide cheap and fast internet. If dem go do dis one, me I personally belive say ee go helep us to bridge dat big gap wey dey between us and develop countries as ee concern INFORMATION and KNOWLEDGE.

1 comment:

  1. Abi ooo.
    Even 4 9ja, where all these comfort no dey, tribalism no dey wound us for there?
    It is better to cry in a Bentley than in danfo - p square.
    Glad to hear, you are okay.
    Laziness? It happens sometimes.
    I will revert to my draft and publish, when I am in a limbo.
    Whenever the muse decides to visit me, I will write as I am lead and save. So when the 'drought' period comes, I simply go to my reserve.

    ReplyDelete

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...