DE AMISH PEOPLE

You know say when pessin say wondas shall neva end!, dat pessin dey talk about sometin wey really surprise am? Yes dat one happen to me recently. I find out about dis people wey dem dey call Amish for de frst time.

I dey drive for road one day, den I come see dis guy and im woman been dey drive dem horse and cart. Dis one na wetin I see for township. Na sometin wey I no eva tink say I fit see for dis side of town.


When I pass dem come look inside dem cart, I see as de guy dress exactly like Abraham Lincoln been dey dress, with im bia bia and long cap. And im wife dress like sa na 18th century we dey. Dem just dey ride jeje de go. And I notice say dem been get vegetables for de back of dem cart.

Na lata I come find out say dem come town to supply vegetables to de supermarkets hia. Dis na how dem dey take survive. Dem be mainly farmers. Infact na de major work wey all of dem dey do. Dem dey live separate from everybody. And if you no be Amish like dem, you go fit live with dem.


Dis Amish people na immigrants from Germany. Dem don tey for yankee, and dem neva change as dem been dey live since dem come dis country. Ee get some tins wey dem dey still do today wey go surprise you.

Numba one tin be say dem no dey drive moto, dem no dey drive or enter anytin wey get engine inside. Dem no dey ever use zip for dem dress (yes I mean zip!). Dem no dey watch tv or listen to radio. Dem women no dey eva use make up. I even hia say dem no dey use electricity ( I no too sure about dat one, but na wetin I hia).

Dem get dia own skool for dia colony (dem dey call dem village- colony). So dat one mean say dem no dey go skool wey odas dey attend. And dem skool dey stop for eight grade hia (dat one na JS2). And dem must marry dem sef. You must no marry pessin wey no be Amish.

Amish na one form of Christianity. And dem get dem own special doctrines wey I no too know wetin dey inside. Dem dey too secret for de way dem dey live dia life. And anoda tin na say dem no dey like to take picture. Infact ee dey against dia religion.

I tell you eh..., pessin dey hia say some kind Christian denominations dey special, but I no know any one wey special pass dis guys own. And for de fact say dem don dey reach now and nothing don happen to dem (civilization neva fit change dem), I really comot cap for dem.





1 comment:

  1. I being watch one documentary like that about dem. Some certain amish dey use electricity, drive motor and use mobile phone I don forget the name of the type. Even dem do reality show for dem when dey come Newyork for the first time, their pipo come shun dem! I too doff my gele for dem, because, I wonder how dem fit know wetin dey happen around the county and how dem fit migrate go other places without entering train or ship or plane? Dem stop for 8th grade kwa? so how dem come get dokita, lawyer and engineer for dem midst? Hmm, I just dey wonda like you.

    ReplyDelete

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...