MARTIN LUTHER KING BOULEVARD

As me and one of my friends been dey stroll for him moto one day, we reach one junction like dat. Den I come tell am to turn left so dat we fit see wetin dey dat street. My friend say lai lai him no go enter dat street for dis night.

'Ah ah.., wetin do de street?', be wetin I come ask am. My guy come tell me say dis side of town na de rough side- na de south side. I come later find out say de name of de street na MLK boulevard. Dis na short form for Martin Luther King boulevard.
Every town for yankee get at least one street or drive or lane wey dem name Martin Luther King. And na dat side wey akata people plenty pass. And make I tell you, no mata de town wey you dey, dem own MLK dey always get de same kind of environment and de same kind of tory about de place.

First of all, dis area na no go area for onyibo people. Once most of dem see de sign, na drive pass be de next tin. For dem mind na say de akata people dia go do dem sometin. Even some ajebotarized akata people dey stay far from MLK street.

De popular idea of MLK na say ee no dey safe, or na place wey hard drugs dey plenty, and na place wey korofo dey always patrol 2-4-7! For me sha, wetin I dey usually see na poverty. Na hia you go see people wey no too get opportunity to beta dem sef. Most of de houses no too fine, and de road dem no too good.

Maybe if govment go try spend some of de money wey dem dey carry go pour for de onyibo people side, den de place no go always dey like as ee dey. South side for any yankee town dey always be de poor people area, and MLK be like de capital of dat area.

And wetin come make de mata worse be say de bad part of every town for dis country, always get one street wey dem name afta de main guy wey fight for justice and beta life for poor people. And na dis one go make you to dey wonda weda de man waste him time and him life for nothing.




1 comment:

  1. Hmmmmm na wa ohhh!!!lol dem for knack u and ur guy Akpako!!!

    ReplyDelete

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...